Omo, the Remo Stars 2025 Awards night na real gbas gbos! E full of surprise, better groove, and plenty gbas for players wey tear eye throughout the season.
Dem even celebrate say na dem carry NPFL trophy for the first time ever, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Tochukwu, Adebayo & Akinyele Scatter Ground for Remo Stars 2025 Awards
Midfielder wey dey ball for home soil, Tochukwu Michael, collect Goal of the Season after him thunderbolt goal against Rangers for Ikenne tear everywhere—fans vote am as the best goal wey enter net for 2024/2025 season.
But Tochukwu no stop there. Him still carry Most Assists and Most Appearances join body—omo na consistency choke!
As for Olamilekan Adebayo, baba na the real MVP. E pack plenty awards go house:
Player’s Player of the Season
Fans’ Player of the Season
Top Goalscorer of the Season
Na him ginger and leadership help Remo Stars lift NPFL title for the first time since dem start to dey play ball.
To show say dem sabi appreciate better player, Club President Hon. Kunle Soname dash Adebayo brand new GAC SUV—sharp ride wey clean like today bread.
Young Stars No Dey Carry Last – Akinyele Na Real Gem
Young baller and Naija U-20 player Ahmed Akinyele carry Young Player of the Season award—even though e no dey, e still show love from where e dey:
“To win Young Player of the Season na big blessing. I thank my coach, my guys, and una wey be fans. Na all of us win this one,” Akinyele yarn for Twitter.
For the babes side, Bolaji Olamide burst net with her goal against Heartland, na why she collect Women’s Goal of the Season, and she still win Fans’ Women’s Player of the Season as she knock in the highest goals.
Other people wey collect award include:
Bashiru Kafayat – Player’s Player (Most Assists)
Olasubomi Ogundele – Young Player of the Season
Plenty Money Rain – President Run Package
To close the matter with better style, President Kunle Soname drop ₦42 million cash for reward:
₦25 million go to the Men’s Team for winning NPFL
₦10 million go to the Women’s Team for reaching NWFL Super 6
₦5 million for Beyond Limits wey win Gothia Cup for Sweden
₦2 million to the Supporters’ Club
This Remo Stars 2025 Awards no just celebrate ball alone, e show say Remo Stars dey serious with talent, hard work, and community love—na big example for other NPFL clubs.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on July 22, 2025 2:45 pm by Hitvibz Media






Stay connected