Enugu Rangers don continue dia strong waka to carry the Nigeria Premier Football League (NPFL) trophy after dem wire Bayelsa United 2-0 for dia own backyard for Yenagoa on Sunday.

Enugu Rangers celebrating 2-0 win vs Bayelsa United

This win don make dem expand dia lead for the top of the table. The Flying Antelopes control the game well-well as dem score for first half and second half, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Rangers make dia title hope strong as Rivers United and Shooting Stars show body

Chidiebere Nwobodo na him first nak the ball enter net small time after thirty minutes play, and that goal give the visitors the liver dem need.

As the game wan finish, Godwin Obaje come carry the win lock when he score with just five minutes remain for clock to make sure say the three points follow dem go home.

Enugu Rangers 2-0 win over Bayelsa United

With this result, the Coal City boys still dey sit down lekere for the top of NPFL table with 62 points after 36 matches. Dia eye still dey the trophy gidigba.

  “We Go Fight Wella” — Rangers Oga Fidelis Ilechukwu Warn Rivers United Because of NPFL Title

Rivers United, wey dey second position, no gree slow down as dem pressure the leaders with beta 3-0 win against Abia Warriors.

Wasiu Falolu open floor early for second half after he finish one correct header wey Handsome Surveyor arrange give am.

Timothy Zacharia double the lead with one calm strike before Bello Babatunde come use one long-range bullet finish work for the last minutes of the match.

This win mean say Pride of Rivers still dey follow Rangers for back with just one point difference. The league don hot now as dem dey prepare to jam Wikki Tourist for Jos.

For Ibadan, Shooting Stars (3SC) don climb go third position after dem win Nasarawa United 3-2 for inside one match wey hot well-well.

  Ex-NPFL star Echeta Deputy score again for third match straight, drop brace carry Zakho climb Iraq Stars League table

Lucky Emmanuel score two goals inside the first 24 minutes, but Nasarawa fight back through JoFrank Istifanus and Habibu Alakija.

However, Qamar Adegoke come be the hero as he score the winner for Shooting Stars just before the match enter stoppage time.

For other side, Enyimba boost dia hope to stay for the league after dem come from back beat Remo Stars 2-1 for Aba.

After Victor Mbaoma score early for Remo, Stanley Dimgba draw the match before Chidera Michael nak the winning goal for early second half.

Kun Khalifat also get important 2-1 win against Kano Pillars to commot for relegation zone, sake of one last-minute goal wey enter after the two teams don first trade goals.

Warri Wolves beat Plateau United 1-0 for Ozoro through Tejiri Emonena first-half goal, while Barau FC do over-doing as dem flog El-Kanemi Warriors 3-0 with goals from Sunday Anthony, Henry Ezeonye, and Joseph Atule.

  Who Fit Stop Dem? Wikki Tourists, Barau FC, Kun khalifat & Warri Wolves Don Land for NPFL

Full NPFL Matchday 36 Results:

Barau FC 3-0 El-Kanemi Warriors
Niger Tornadoes 2-2 Kwara United
Enyimba 2-1 Remo Stars
Bayelsa United 0-2 Rangers
Rivers United 3-0 Abia Warriors
Kun Khalifat 2-1 Kano Pillars
Warri Wolves 1-0 Plateau United
Shooting Stars 3-2 Nasarawa United

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on May 3, 2026 11:05 pm by Hitvibz Media