Defending champions of di Nigeria Women Football League (NWFL), Bayelsa Queens, begin dia Super Six title defence with tight 1–1 draw against debutants Abia Angels on Saturday evening.

NWFL Super Six action at Adokiye Amiesimaka Stadium Bayelsa Queens vs Abia Angels

For di final match of Matchday 1 for di 2026 NWFL Premiership Super Six Finals, Abia Angels come from back to hustle one point for Adokiye Amiesimaka Stadium, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Bayelsa Queens First Score For NWFL Super Six Opener

Bayelsa start di match with full chest and dem bin tink say dem don take lead after one heavy header enter net, but referee cancel am say na offside.

NWFL Super Six Bayelsa Queens attack against Abia Angels defence

Dem almost score again short time after, but dis time di ball waka go outside. Di first half bin quiet and tight, as no team fit see road enter net.

Eleven minutes after second half start, Abia goalkeeper Fatimah Oloko miscalculate one ball, come make di ball drop well for Harmony Chidi, wey use header put Bayelsa Ladies for front.

  Naija Ratels oga say na grassroot babes em use play Rivers Angels — still dey para say Super 6 sure for dem

Just one minute later, referee give Abia ladies penalty. Di goalkeeper dive go di correct side but she no reach on time, as Mariam Abdulrasheed step up come sharply balance di game, make am 1–1 from di spot.

Abia Angels equaliser penalty NWFL Premiership Super Six Finals

As time dey go, another mistake from Oloko almost dash Bayelsa another goal. But dis time, she try cover her mistake come catch di ball, even though she carry injury join as she dey save am.

  President Federation Cup: Rivers Angels Scatter Abia Angels as Bayelsa Queens Chop Disgrace

Abia Angels Fight Back To Hustle One Point

Small time after, Abia carry counterattack pass right side. Dem cross ball enter box, one strong header hit pole come bounce out before dem clear am.

Abia Angels hijack the spotlight from defending champions

One minute after that one, Bayelsa run dia own counter. Once again, Oloko rush comot from her post for risky move, but dis time di Bayelsa striker ball pass outside.

Di match sweet well well, fire for fire, as defending champions create plenty chances, but strong and organized Abia Angels defence no gree for dem, as both teams finally settle for one point each.

  Mary Aderemi: Another Naija Babe Don Follow Blessing Nkor Go Belarus Women’s League
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on June 6, 2026 8:32 pm by Hitvibz Media