Rivers United don finally break di jinx of six months wey dem never win for away. Dem do am style-style for Matchday 37 for inside Nigeria Premier Football League (NPFL).

Rivers United beat Wikki Tourist 3-2

Di Pride of Rivers travel go Bauchi go face Wikki Tourists for Abubakar Tafawa Balewa Stadium, and dem carry 3-2 win come back Port Harcourt after serious struggle, Footballrover reports.

Rivers United Don Secure Champions League Ticket For Bauchi

Dis win na only dia second away victory dis season, and e mean say dem still get hope to lift di trophy.

Even though Wikki first score dem, di Port Harcourt boys show say dem get liver as dem fight back well.

As Finidi George dey yarn about di hot match, e talk say:

Di match tough well-well as we fall 1-0, and later 2-1. We gbakas enter di game back, and di boys give everything for di last six minutes to score di third goal. E no easy at all.”

Finidi George smiling after Rivers United secured three points away from home

Despite say di fans for stadium dey against dem, Rivers United maintain dia level. Di coach hail him players as dem stand gidigba under pressure.

  "E Dey Happen” — Rivers United Coach Say Na Tiredness Make Barau FC Knack Dem 4–1 for Kano

“I must salute my boys; I think na dia first match be dis for here (Bauchi), so home support bin dey push di other team to win. But at di end of di day, we carry di three points, and na wetin matter be dat,” na so e add join.

Finidi Dey Eye NPFL Title For Final Matchday

With dis result, Rivers United still dey follow Rangers International for back—na only one point gap.

As di season dey end so, na only these two heavyweights remain for di race for di trophy.

Rivers United players celebrating a goal against Wikki Tourists in Bauchi

While other teams dey find way to enter continental slots, Finidi face him work for house.

  NPFL Matchday 13: Ikorodu City dey top, Insurance give fans joy, Rivers still dey run unbeaten

Di coach talk about di pressure for di title and how other teams dey struggle:

We dey go house go see how we go take win our home match, then we leave di rest for God. Any result wey happen for other side, e no concern us like dat, even though Rangers dey front.

We know say Ikorodu self dey look for something, dem want dat third place, so di match go tough for dem too. But for our side, we must win our home match.”

Apart from di title race, dis win don confirm say Port Harcourt go play for continental next season.

Finidi no hide mouth at all as e dey brag about di level wey di club reach pass others.

Dis qualification wey we get sweet well-well. Now we go see how we fit win di trophy. To get CAF Champions League ticket back-to-back for two years na better level,” na so di coach talk.

Rivers United players celebrates 3-2 win over Wikki Tourist during NPFL matchday 37

E end am with bold talk about di club status:

  “We go defend well” — Rivers United oga Finidi open up on game plan for CAFCL match vs Power Dynamos

Na better job be dat. Plenty teams dey find dis position wey we dey, but e no dey come dia way. We must hail di players for dat kind mentality, to qualify twice inside two years; I think say e pass mark.”

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on May 11, 2026 8:41 am by Hitvibz Media