Omo, the Port Harcourt zone for NLO U19 Youth League no carry last at all. Na tension, na gbas gbos, na proper Naija football wahala wey end the group stage.
Everybody dey warm up for knockout like say na Champions League final, na weytin hitvibz dey yan be dat.
De Cardinals vs Cynosure Feeders – Na Draw Settle Dem
This game na the one wey everybody dey wait for. Table toppers vs big chasers. Na El Clásico of PH zone be this one.
21st minute, Paul Benedict rise like prime Ronaldo wey dey nod ball pass Patrice Evra.
Lenee Mtamabari deliver one corner wey sweet like nkwobi, Benedict just nod am inside net. Boom! 1–0.
From there, De Cardinals begin dey show swagger. Possession full their side, dem dey waka ball like Pep Guardiola dey coach them.
But Cynosure Feeders no gree shame catch them. As match wan finish, 81st minute, Miracle Azi live up to him name.
Bros dey inside box like Lewandowski wey dey find small space, just hammer equaliser. 1–1.
Na so dem share the spoils. Cynosure still dey breathe down De Cardinals neck like Arsenal dey always disturb Man City but never fit collect title.
Benedi United vs YWAM Impact – Benedi Hold Body
Second game, e no even reach five minutes, Hassan Suleiman don knack goal.

Na pure striker’s finish, close range, sharp like Osimhen wey dey find palliative for Serie A.
YWAM try, dem hustle, but Benedi United lock shop. Na all three points dem carry go. E sweet them, but na late joy because group stage don nearly close shop.
PH NLO U19 Youth League Group Table Final Gist
See as e end:
De Cardinals – remain unbeaten with 10 points. Dem dey waka dey chest out and shoulder pad like Napoli for their unbeaten run.
Cynosure Feeders – dem dey stubborn, fimish with 8 points, dey follow behind like Liverpool dey follow Man City.
Benedi United – 5 points. Win last game but e no too carry weight. Dem just manage finish 3rd.
Dolphins Academy FA – 4 points. Dem try small, but na just small, nothing come out.
YWAM Impact – 0 points. Kai! Dem turn ATM for this group. Everybody just withdraw points from their head. 😭
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on August 20, 2025 9:31 am by Hitvibz Media




Stay connected