Enyimba head coach, Stanley Eguma don yan say im get correct plan for di 2025/26 Nigeria Premier Football League (NPFL) season: na either dem win di league, or at least, carry continental ticket.
As e dey talk for di club official website, Eguma don open mouth yan wetin dey im mind as di People’s Elephant dey gather muscle for pre-season ahead of Matchday 1 wey dem go knack newly promoted Barau FC, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Stanley Eguma Don Set Big Target for Enyimba Elephants
Dis coach wey don win NPFL title two times plus Federation Cup with Rivers United (wey dem dey call Dolphins before), sabi say e no easy to handle club wey don win plenty like Enyimba.
“Enyimba as team get target, and me as coach wey get big ambition, I sef get target. And my own target na to win di league or collect continental ticket, worst case,” na so im take talk.
Eguma no dey look back, im dey aim higher.
“As I don achieve that one before, I dey reason say make I do pass that one. And na wetin di club sef dey plan. Make una no forget say we don win NPFL 9 times, and we be two-time African champion. Anything wey no reach that one no be better achievement.”
Enyimba No Be Small Club – Eguma
Di coach still talk say di target wey im set for himself na same line with wetin Enyimba stand for, as one of di baddest football clubs for Naija.
“Before di management go even talk target give me, I don already get my own. I too get big dream, and I sabi say I fit deliver.”
For Eguma mind, average no dey Enyimba body at all.
Last season, Eguma come join mid-season when dem dey 11th, but im still push dem reach 6th position.
Now wey full season dey ahead, im dey plan to carry Enyimba go back top where dem belong.
Eguma still get correct experience for CAF Champions League, as im bin be assistant to Okey Emordi when Enyimba dey defend title for 2004 – dat one dey ginger im continental hope now.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on August 7, 2025 5:10 pm by Hitvibz Media



Stay connected