NPFL Wahala: Relegation-bound Nasarawa United don go show Remo Stars shege—Even coach Dan shock

Remo Stars players
Share this

Remo Stars dey run things for NPFL, but dem waka enter Lafia come meet wahala wey dem no expect, dem jam lion wey dem think say no dey bite and na so them take cut people ticket.

NPFL Wahala: Relegation-bound Nasarawa United don go show Remo Stars shege

Nasarawa United, wey dey fight relegation, shock everybody as dem knack di league leaders 1-0 for inside their own backyard, Hitvibz reports.

But na wetin Remo Stars coach talk after the match come scatter ground—e no believe say team wey dey struggle fit show dem shege like this.

Nasarawa United don show Remo Stars shege with killa goal

E just take one better chance for Nasarawa United to nack Remo Stars proper shege pro max.

Na for 25th minute e happen, as left-back Mubarak Hussaini send one wicked cross enter box.

Remo Stars training

Who come dey there? Anas Yusuf, wey no dey joke this season. The guy sharply put ball for net, make e 14 goals for the season.

Remo Stars try press dem, but Nasarawa United no gree oh!. The Solid Miners stand gidigba, block road, and hold their 1-0 lead till final whistle.

This win na big statement for dem as dem dey find how to comot from relegation wahala.

Coach Ogunmomode confess say e no understand wetin happen

After the match, Remo Stars coach, Daniel Ogunmomode, gats open mouth confess say e shock as dem no fit break Nasarawa United defense.

E talk say e no even understand how dem dey relegation zone with the way dem dey play.

NPFL Wahala: Relegation-bound Nasarawa United don go show Remo Stars shege—Even coach Dan shock

We try our best today, but e no reach. Nasarawa United need the points pass us, dem play well, and dem deserve the win. I still dey wonder how dem take dey bottom table with this kind football. We no too create chances, na why dem beat us,” Ogunmomode talk.

This loss na Remo Stars’ seventh for the season, and e don cut their lead for top from 10 points go 9. If dem no shine eye, NPFL go balance well.

Like this post?
We’d be delighted to hear from you. Please leave a comment in the box below!

Be the first to comment on "NPFL Wahala: Relegation-bound Nasarawa United don go show Remo Stars shege—Even coach Dan shock"

Leave a Reply