Management of Katsina United FC don commot talk say make all players, coaching staff, and backroom crew go on compulsory three-week break since the league don end.

Katsina United players during 2025-26 NPFL season break announcement

Na the Club Chairman and Supervising Coordinator, Alhaji Surajo Malumfashi, sign the official statement wey dem send to the Changi Boys media team, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Katsina United Give Strong Warning Before NPFL Off-Season

Based on the order wey pure from the top, the compulsory break go start from Sunday, May 31, 2026, and e go end on Sunday, June 21, 2026.

Alhaji Malumfashi wish the team well make dem go enjoy beta holiday with dem family, but he still fire heavy warning join.

The club oga dem warn all the players and workers black and white about how dem suppose take resume.

  Ahmed Musa Bang Match-Winner as Kano Pillars Win, Abia Warriors and Enyimba Draw, Rangers Fall

Katsina United warn players of sanctions ahead of resumption

Management clear am put say anybody wey fail to show up for camp on top time on that June date, na heavy fine dem go pay and the club go handle dem with strict disciplinary action.

Katsina United Core Stats: How the 2025/2026 Season Take Go

This strong face wey management dey show dey come after the 2025/2026 Nigeria Premier Football League (NPFL) season close curtain on May 24, 2026.

Enugu Rangers na dem win the league cup, while Rivers United finish for second position after dem wire the Changi Boys 3-0 for the last match wey dem play for Port Harcourt.

  We Suppose Give Kudos to Akwa United, Dem Deserve to Win Us Sha – Enyimba Coach Finidi George

Katsina finish the 38-game season for 9th position for table, as dem pack 52 points from 14 wins, 10 draws, and 14 losses.

Even though dem chop 39 goals, the team still show small fire for the league.

Katsina United squad after completion of NPFL 2025-26 campaign

Their star striker, Uche Collins, try well well as he score 13 goals to carry 4th position for the whole NPFL highest goal scorers chart.

The fans non go forget the tension and jollificaton of that 4-4 draw wey dem play for Wikki Tourists away ground, and the correct 4-1 wey dem take beat Ikorodu City clean up.

  Rivers United GM Okey Kpalukwu Chop Serious Beating as NPFL Wahala Burst for Kwara United Match
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on June 1, 2026 9:28 am by Hitvibz Media