We Suppose Give Kudos to Akwa United, Dem Deserve to Win Us Sha – Enyimba Coach Finidi George

We Suppose Give Kudos to Akwa United, Dem Deserve to Win Us Sha – Enyimba Coach Finidi George
Share this

Enyimba Football Club’s oga coach, Finidi George, don yarn say e dey vex afta hin team lose for one Nigerian Premier Football League (NPFL) match against Akwa United.We Suppose Give Kudos to Akwa United, Dem Deserve to Win Us Sha – Enyimba Coach Finidi George

Upon everytin Enyimba do to climb reach top for table, dem still suffer 3-1 lose against Akwa United for Godswill Akpabio Stadium, Uyo, Footballrover reports.

Akwa United, wey dey chook eye to waka commot from relegation zone, show strong spirit and power early for di game, as dem take lead through David Phillip’s seventh-minute strike.

Sani Suleiman come kuku extend dia lead to 2-0 for di 51st minute, as e put Enyimba under pressure.

Even though Chijioke Mbaoma manage score penalty for di 72nd minute wey give the People’s Elephant small hope, Suleiman’s second goal just come from nowhere scatter dia plan.

As the game finish, Coach Finidi George begin para, talk say e dey vex with Akwa United’s time-wasting tactics, especially as dem dey delay game with ball boys wey dey hold ball.

Wetin I no like na di fact say when una dey win, balls dey vanish; Akwa United pass dat level,” di coach yarn.

E stress di need for professionalism and suggest say Akwa United fit use other strategies, like possession football, to keep dia advantage.

Akwa United suppose do beta for dat one because if other teams do di same to dem, dem no go like am,” e talk.

Upon say em dey vex with di lose, Finidi still get mind salute Akwa United for dia win wey dem deserve, as e agree say dem play pass Enyimba for field.

Akwa United deserve to win; we must give dem dat credit,” e talk.

Di lose don kuku make Enyimba drop go fifth position for NPFL table, while Akwa United climb reach 17th position.

You like dis post?
Abeg, drop your comment for di box below, we go happy well well to hear from you!

About the Author

Kris
An educationist, who loves good music and Football. A creative writer, footballer and content editor.

Be the first to comment on "We Suppose Give Kudos to Akwa United, Dem Deserve to Win Us Sha – Enyimba Coach Finidi George"

Leave a Reply