Abdullahi Maikaba, wey be the head coach of Kano Pillars, don yan im vexation wit di officiating afta em team lose 1-0 to Abia Warriors for one correct NPFL match wey dem play on Monday.
The Sai Masu Gida swallow their ninth league defeat as Daniel Ijeh tear net for Abia side for di 78th minute wey make dem win for General Sani Abacha Stadium, Footballrover reports.
E shock the coach wella as di Warriors snatch di victory and carry all three points for di end of di match dey go house.
The Sai Masu Gida came out in their numbers as usual to support their team Kano Pillars at the Sani Abacha Stadium.????#NPFLLive#NPFL24 pic.twitter.com/sji3tzIY5z
— NPFLLive (@NPFL_Live) March 5, 2024
Maikaba, as e sit down dey reason things about di match, talk say e believe say na bed belle bin dey follow em team and say dem miss plenty chances to score against di Ochendo Boys.
“We waste plenty scoring chances. Abia Warriors no suppose carry di that three points,” e shout.
The coach still gather mind criticize di officiating, especially di decision wey lead to di crucial corner kick wey bring Abia Warriors goal.
“In short, I no dey happy with di officiating,” di coach lament.
Despite di tori of how dem lose, Pillars still dey run neck to neck for for di NPFL table, dem dey sixth place with 36 points, wey be just six points behind league leaders Lobi Stars.
Incredible win for Abia Warriors at Kano Pillars, beautiful moment(s) we live for in the NPFL.
Sporting Lagos with an away point at Doma United.
Akwa United fighting for survival with an important win at home against Enyimba.
Matchday 23 has served us premium drama.
Gombe… pic.twitter.com/TYcYlQwxNE
— Adepoju Tobi Samuel ???????? (@OgaNlaMedia) March 4, 2024
As dem dey look forward, Kano Pillars go now take time prepare for their next match against Rivers United for Port Harcourt on Saturday.
With hope to bounce back, di Kano Boys go surely wan try come back to winning ways and ginger their campaign for di Nigerian Premier Football League.
Be the first to comment on "Referee Wahala: Kano Pillars Coach Dey Vex say Ref Scatter Match Wey Dem Lose Bad-bad to Abia Warriors"