Na so e be, my people. Victor Mbaoma don carry im leg waka come back NPFL and e no waste time show say class no dey fade.
Remo dey play Rivers United for dem first match of 2025/26 season, and na Mbaoma run am for dem to secure 1-1 draw, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Rivers United Start with Fire, Mbaoma Quench Am
Na Finidi George team first open book. Just three minutes, Okon Aniekeme don burst net, shock the defending champs for dem home turf.
Abeokuta fans never even balance beer for hand finish, ball don enter.
But who come rescue di Sky Blue Stars? Na the man wey dem dey hail –Mbaoma. Just five minutes later, baba equalise sharp sharp.
Na that kain striker wey dem dey call “No Dey Waste Time FC.” Michael Ibe nearly turn the game upside down with one wicked free kick.
If no be crossbar, MKO Abiola go don hear gbosa. First half con end 1-1, and second half na pure tension but no goal enter again.
10-Man Rivers United Still Hold Ground
Extra time con hot like new suya. Temple Emekayi chop red card after wahala, di Garden City team reduce to ten.
You go think say Remo Stars go chop dem alive, but no be so. Di PH boys package well, defend like say dem dey protect mama pot of soup.
Final whistle blow. 1-1. Both teams collect one-one point. Remo Stars fans dey vex small say win no come, but dem still happy say Mbaoma don return with vibes.
We sure say Rivers United fans go dey yarn say, “If no be that red card, na dem for carry three points waka.”
First 10 minutes 2 goals already 🎬#NPFL25
— Pride of Rivers (@PrideOfRivers) August 22, 2025
Abeg, make we no lie. This season don start with gbege, and if Mbaoma fit heal quick from that injury, wahala go dey for defenders.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on August 22, 2025 8:30 pm by Hitvibz Media



Stay connected