My people, our Super Eagles baller Moses Simon finally nack im first goal for Paris FC, but na like person wey use pure water quench pepper soup – e sweet small, e later pain.
Because Marseille vex that night, flog Paris 5-2 for their backyard, Stade Vélodrome.
Simon gats shine face as he equalize, but as Marseille firepower land, Paris defence scatter like NEPA wire wey breeze blow.
Moses Simon Score, Paris Still Fumble
64th minute, na there Moses show himself. Ilan Kebbal serve am beta ball, Simon slide am enter net like CR7 inside training ground.
Goal sweet d!e, and e even special – na im first-ever goal against Marseille after 11 dry meetings when he dey Nantes.
Before that, Kebbal sef don ginger with one goal wey reduce Marseille lead after Greenwood and Aubameyang don already toast Paris with 2-0 like cold beer for bar.
When Simon equalize, hope dey. We dey shout “comeback loading!” But my brother, na fake alert.
Marseille No Dey Joke At All
See as Roberto De Zerbi boys take vex. Just like Man City after conceding for Champions League, Marseille balance back sharp-sharp.
Aubameyang, wey dey behave like say na backyard training, score another one. Before Paris fit breathe, Højbjerg scatter net from long distance – na that kain goal wey dey make keeper wan apply for pension.
As if na play, Robinho Vaz add pepper for injury with stoppage-time strike. Paris pack 5 goals inside basket, carry go home like house wey dem don repossess.
Marseille Celebrate, Paris Carry Last
For Marseille, na big statement – first Ligue 1 win of the season and dem don still maintain their home juju for Vélodrome. Their fans go dey ball for bar till morning.
As for Paris FC, dem don cement bottom of table like Arsenal under Wenger last days. Defensive wahala full ground, missed chances scatter everywhere.
At least Moses don finally score, but bros, football no dey respect sentiment. Marseille firepower na like Real Madrid inside Champions League – e no get who you be.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on August 24, 2025 6:52 am by Hitvibz Media




Stay connected