Super Eagles baller Ademola Lookman reveal Diego Simeone instructions wey em give am before e enter pitch come make big difference for Atletico Madrid 2-0 UEFA Champions League win against Manchester United.

Ademola Lookman reveals Diego Simeone instructions after Atletico Madrid's 2-0 win over Manchester United

The Nigerian attacker talk say coach give am clear instruction: make e bring fresh ginger, help the team defend well, and grab any attacking chance wey show face, na weytin Hitvibz dey yan be dat.

The Super Eagles star enter from bench come score Atletico second goal for Riyadh Air Metropolitano Stadium. The goal end him six-match goal drought and help the Spanish side collect important victory for Europe.

Ademola Lookman Reveal Diego Simeone Instructions Wey Make Am Deliver

As e dey yarn exclusively with CBS Sports Golazo after the match, Lookman explain say Simeone want make e enter the game with fresh ginger and contribute both when dem dey attack and when dem dey defend.

Ademola Lookman speaks to CBS Sports Golazo after Atletico Madrid's Champions League victory

“Just bring the energy, try to help the team defensively of course, and offensively when I get the chance to, so yeah, bring the energy,” Lookman talk when dem ask am wetin Atletico manager tell am before e send am enter pitch.

The instruction no too get plenty grammar, but the 28-year-old deliver exactly wetin him oga need when the game dey hot.

Lookman replace Alex Baena for 71st minute and quickly join the attack.

One of the moves wey e involve inside contribute to the sequence wey later lead to Leny Yoro red card after VAR check. Just eight minutes after e enter, the Nigerian don put ball inside net.

  “I dey do my work well” — Victor Osimhen nack chest after him derby goal keep Galatasaray for front

For Simeone, the substitution bring extra attacking power against Manchester United, wey don reduce to 10 players. For Lookman, na another chance to remind the Atletico boss say e still get wetin e fit offer the team.

The Nigerian attacker also give credit to him teammates, as e admit say dem don work hard before e enter the match.

“Yeah, I’m very happy to come on and help the team is important. Obviously the guys put on a big performance before I came on, so it’s easy to come into the team and then turn to play, so I’m very happy with the team’s performance,” e add.

How Ademola Lookman Finally Break Him Goal Drought Against Manchester United

You know as football fit be sometimes. You go dey try your best, but the ball no just wan enter net. Before this Champions League showdown, Lookman don dey carry the matter for mind.

  Simy Nwankwo nak brace take reach 25 goal contributions as Muhamed Tijani assist Spartacus win

Ademola Lookman celebrates ending his goal drought for Atletico Madrid

The Super Eagles star never score since August 29, when Atletico beat Sevilla 3-1 for La Liga.

That one mean say na 45 days and six straight matches wey pass without goal contribution for club and international matches.

E no score against Athletic Club, Liverpool, Real Sociedad, CA Osasuna, Real Madrid and Alavés. E also fail to find net during Nigeria World Cup qualifying matches against Madagascar and Guinea-Bissau.

As the goals no dey come, Simeone temporarily move the Nigerian star go bench and prefer to start with Baena, Giuliano Simeone, Julián Álvarez and Lee Kang-in for attack.

But na so e be for football: when chance show face, na you go prove yourself.

Lookman grab him own moment against the Premier League giants and end the goal drought with style.

The goal come for correct time as the Nigerian dey try find back the scoring form wey make am one dangerous player for attack.

  Simy Nwankwo Score 20 League Goals As Mubarak Suleiman Score But Slavia Prague Chop Heartbreak

Lookman know how important the victory be, but e warn say the team no suppose allow one good night make dem lose focus on the next match.

“Of course we know how big of a win that is for us, it puts us into confidence for the next game, which is on Saturday or Sunday, so yeah, game after game. Game after game,” e tell CBS Sports Golazo.

Atletico don now win five matches back-to-back for all competitions since Liverpool beat dem for Anfield.

The winning run don give the Spanish side better confidence as dem prepare to travel go face Espanyol for La Liga before dem head to Germany to play Stuttgart for Europe.

Last Updated on October 14, 2026 8:45 am by Hitvibz Media