Our Super Eagles forward, Kelechi Iheanacho, show pepper on Sunday as he nak two quick goals inside five minutes take ginger Celtic to beta win against St. Mirren for their Scottish FA Cup semi-final ball.
The Nigerian star enter from bench come score two late goals—the third and the fifth one—as Celtic wires their visitors 6–2 for Hampden Park, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Kelechi Iheanacho fire two goals take push Celtic go final
The 29-year-old striker use only 13 minutes for pitch take change the game after he enter for 83rd minute to replace Yang Hyun-jun.
As e be so, Iheanacho don score three goals for his last three matches for the club, after he first wire one for their 2–1 win against Dundee F.C. on April 5.
The former Leicester City star, wey don already get three league goals, don increase his total tally to six goals and one assist.
Celtic don pick their ticket for the Scottish Cup final where dem go jam Dunfermline Athletic, after that heavy win against St. Mirren.
Even though the scoreline big, the match no be beans at all as the eight-goal drama reach extra time before person sabi who win.
For start, di Hoops be like say dem go just waka over them after Daizen Maeda score for the first minute, and Anthony Ralston add another one just before half-time.
But St. Mirren show say dem get liver. Even though their goalkeeper Ryan Mullen wound early—wey make one 17-year-old boy, Grant Tamosevicius, do his professional debut for inside heat—the Buddies still fight back.
Mikael Mandron nak two goals, including one dramatic equalizer for 91st minute, wey push the game go extra time.
Iheanacho finish the drama with better performance
The tie finally burst for extra time when di Bhoys wire four goals inside six minutes.
Iheanacho wey enter sub nak two, while Luke McCowan and Benjamin Nygren—wey score his 20th goal this season—follow join body take bury St. Mirren hopes.
This win don set up better final for May 23, where two oga go jam: Martin O’Neill and his former player, Neil Lennon.
The match na repeat of the 2007 final, and Celtic dey look to add more trophy to their record-breaking park.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on April 19, 2026 6:10 pm by Hitvibz Media
Related
Kelechi Iheanacho fire two goals inside five minutes take carry Celtic enter Scottish Cup final



Stay connected