E be like say dis 2025/26 season go too sweet for Super Eagles baller Samuel Chukwueze as e knack one correct goal wey ginger AC Milan to tear Perth Glory 9-0 for one friendly match wey shelle Thursday afternoon.

Samuel Chukwueze Burst Net as Milan Wack Perth Glory 9-0, Fly Enter Cloud 9

Di Naija superstar start the match, and na him score di fifth goal, one sweet finish wey scatter everywhere as Milan use dem play like say na training, na weytin hitvibz dey yan be dat.

AC Milan No Pity Perth Glory – Dem Tear Dem First Half

From kickoff, Milan no even gree rest. Just 3 minutes into the match, Filippo Terracciano open the floodgate with one sharp goal wey tell everybody say wahala don start.

  Alex Iwobi Shine Scatter, Chukwueze Two Late Goals Burst Brain for Fulham 9-Goal Wahala Match

AC Milan players hammee Perth Glory 9-0 for friendly game

Noah Okafor come show say him leg dey fire, as e knack two goals back-to-back for 24th and 27th minute. Di boy dey sharp like razor!

Perth Glory never even balance before Christian Comotto carry penalty ball enter net for 30th minute – gbam, na 4–0!

Two minutes later, na our Naija boy Chukwueze turn. Baba control ball well, calm down, finish like pro – 5–0 just before halftime. Wahala!

Samuel Chukwueze don shine for AC Milan’s preseason clash

Milan don finish di work even before referee blow halftime whistle. Na cruise!

Samuel Chukwueze Dey Ginger – Season Go Make Sense

Second half start, Rafael Leão wey enter for Okafor no waste time. Just 2 minutes in (47th minute), baba send another one enter net – 6–0.

  Calvin Bassey Don Score, Chukwueze Dey Gather Momentum as Fulham Manage Win Burnley

Samuel Chukwueze dey celebrate em goal for AC Milan vs Perth Glory

Chukwueze come waka commot small time for Mattia Liberali to enter, but pressure still dey.

By 58th minute, Samuele Ricci scatter another one – 7–0. Later, Yunus Musah join party for 80th minute with better goal.

Rafael Leão no gree rest as e use 86th minute seal him own brace – 9–0! Milan just dey oppress.

Massimiliano Allegri and him boys just dey show say dem ready for season – sharp, deadly and full of ball sense. Fans wey watch live no believe wetin dem eye see.

If na dis kind ball dem go play this season, Milan fans go enjoy well. And Chukwueze? Him own time don finally reach.

  Samuel Chukwueze Don Go Assist Winner as Fulham Jump Go 14th for Premier League

Next Wahala? Chukwueze and him guys go face Leeds on di 9th, then one serious showdown with Chelsea wey be world champs.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on July 31, 2025 2:02 pm by Hitvibz Media