Dis 2025/26 season don dey look like say na Philip Azango time be dis, as di Naija baller just dey scatter net anyhow.

Philip Azango na man of the match for Spartak Trnava’s 5-1 victory

Di 28-year-old no carry last again, e score one correct goal plus give beta assist wey help Trnava slap Hibernians 5–1 for Conference League Qualifiers on Thursday, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Trnava Show Dem Pepper, Beat Hibernians 5–1

Azango show mad skill for City Arena—Štadión Antona Malatinského, help him team waka go next round with 7–2 total goals.

 

Philip Azango dey celebrate.em goal for Spartak Trnava vs Hibernians

From early minutes, e start di gbege wey lead to Libor Holik first goal for 4th minute.

  Philip Otele Don Design FC Basel With Goals – Fire Two Against Grasshopper

No be small thing o! Holik come return the love, set up Stefan Skrbo make e knock in number two goal for 13th minute.

Trnava come dey control everything like say na training match.

Hibernians nearly score penarity but their guy Bjørn Kristensen miss am. Trnava sef get one, but Michal Duris no fit finish am.

Na Miullen finally give Hibernians small hope for 37th minute after Lucas Villela pass am ball, e kon finish am well. But that hope no last long.

Philip Azango Close Di Show as Trnava Continue Their Cruise

Just after second half start, Michal Tomic fire in number three for 47th minute.

  Abduljeleel Abdulateef Give Correct Assist but No Fit Save Odd BK from Ranheim

Philip Azango Score, Give Assist as Spartak Trnava Tear Hibernians Like Paper

Wahala still dey! Pedrao con knock own goal for 54th, before Azango sharply enter box, hammer number five for 57th minute—clean finish!

Dis na Azango second goal back-to-back for Trnava after e score last weekend as dem knack Ruzomberok 3–0.

After di work don complete, coach comot am for 65th minute give Hilary Gong chance.

Wetin Next for Philip Azango and Him Guys?

After this strong win, Trnava go now face league wahala again, as dem go jam Trencin on Sunday.

Philip Azango don score, assist em team Spartak Trnava beat Hibernians

Hitvibz go dey monitor our Naija boy wella, because e dey show say e dey enter beast mode this season.

  Rafiu Durosinmi Land Last Blow as Viktoria Plzen Shock Servette for Switzerland

If Azango continue like this, e fit turn dis season to di best one of him career so far.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on July 31, 2025 9:23 pm by Hitvibz Media