Super Eagles correct left-back, Zaidu Sanusi, no gree play small ball on Monday evening. The guy scatter ground, drop assist wey help hin club FC Porto knack Gil Vicente 2-0 for their own house inside Portugal Primeira Liga.
The 28-year-old Naija international play full 90 minutes, no even breathe, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Na him serve the pass wey Pepe use hammer the winning goal wey end the match. Porto just carry three points waka comot, steady.
Zaidu Sanusi Fire Porto to Second Win Back-to-Back
Matchday two for Liga Portugal, Porto still dey flex muscle. Two matches, two wins. Sanusi don already open hin goal contribution account for the new season — sharp guy.
Their first game? Dem flog Vitória de Guimarães 3-0 for Estádio do Dragão.
That time, Zaidu only chop 36 minutes but e still make sense. Porto use that ginger waka enter Gil Vicente backyard, still collect maximum points.
How Zaidu Sanusi and Pepe Burst Vicente Net
First half, na Victor Froholdt wey open the scoring for 20th minute after Gabriel Veiga deliver correct corner. Froholdt jump like say na volleyball spike, nod ball enter net.
Second half never even start well, na so Zaidu Sanusi and Pepe combine scatter defense. Zaidu carry ball, package better cross from left.
Pepe no dull, arrive like agbero for danfo door, blast am enter middle post. Goal wey close shop, lock key throway for gutter.
Porto carry 2-0 win dey smile, chest don dey rise like puff-puff for fire. Next stop na Casa Pia AC, as dem still dey chase league title with eye wey no dey blink.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on August 19, 2025 7:33 am by Hitvibz Media



Stay connected