Nigerian teenage striker Emmanuel Egeoluoha don complete im move go Serbian SuperLiga club OFK Beograd, as di club officially unveil di highly-rated forward as one of dia newest signings ahead of di 2026/27 season.

Nigerian striker Emmanuel Egeoluoha joins OFK Beograd

Di 18-year-old join Beograd after e comot from Serbian champions Red Star Belgrade, where e spend time dey develop for di club youth team, na weytin Hitvibz dey yan be dat.

Emmanuel Egeoluoha Don Ready for Senior Football Chance

Di Belgrade-based club announce di signing for dia official social media pages, welcome di Nigerian youngster to Omladinski Stadium and praise am say e fit play different attacking positions.

Emmanuel Egeoluoha don join our attack. Dis young Nigerian footballer dey play as central striker, but e sabi deliver well for wing positions too. We welcome am to Omladinski stadion.”

Egeoluoha join Beograd after e rise through di youth ranks of Red Star Belgrade, one of Serbia biggest clubs.

  Onyebuchi Obasi: Hobro IK New Signing Don Talk 3 Qualities Wey Em Go Bring Come Di Danish Club

Di Owerri-born striker first join Red Star from Nigeria Forster Football Academy and na regular player for di club Under-19 side.

At 1.92 metres (6ft 4in) tall, di powerful forward na natural centre-forward, but e still fit play for either wing or as second striker.

Im strength, aerial ability and ability to play different attacking roles don make am one of di exciting young Nigerian attackers wey dey grow for European football.

Naija Striker Dey Chase Big Breakthrough for OFK Beograd

Even though senior team chances no too come for Red Star, dis move to Beograd fit give am better opportunity to break into first-team football as di club dey prepare for di new Serbian SuperLiga season.

  Simy Nwankwo na baba! Naija baller nak brace for Al-Orobah take enter Golden Boot race

During di 2025/26 season, Egeoluoha play 13 matches for Red Star Under-19 team and score for di famous Belgrade youth derby against Partizan, show say e get plenty potential against one of di country biggest rivals.

OFK Beograd announce Emmanuel Egeoluoha signing

Egeoluoha arrival go make sure say Beograd still get Naija player for dia squad after him fellow countryman Aderoju Hameed Ayinde comot from the club.

Di 21-year-old winger don return go em parent club FK Loznica after him one-season loan deal expire for June 30, come end em time with the Serbian top-flight side.

  Esther Okoronkwo fire AFC Toronto go front, score winning goal, assist for beta comeback win

As Ayinde don close him own chapter for Omladinski Stadium, na so another young naija ballet, Egeoluoha, dey ready to start em own journey for the club.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on July 14, 2026 2:26 pm by Hitvibz Media