Super Eagles boys Calvin Bassey and Samuel Chukwueze don remind everybody say dem no be small picks as AFCON 2025 dey close.

Calvin Bassey Scores, Samuel Chukwueze Builds AFCON Momentum as Fulham Edge Burnley

Bassey collect full spotlight as Fulham edge Burnley 3–2 for Premier League, while Chukwueze dey quietly build form like generator wey just start warm, na weytin hitvibz yan be dat

Na correct timing be this.

Calvin Bassey Carry Fulham Cross Burnley Bridge

Bassey play big role for Turf Moor, score Fulham second goal wey turn match back for visitors favour. Na defender wey sabi when to join attack.

The 25-year-old no waste time at all. From corner kick, baba react sharp sharp, tap am from close range, and boom — first goal of the season after 16 appearances. Defender don open account, beer parlour scatter.

  “Make e Continue Like Dis” — Ademola Lookman Body Dey Sweet Am as Atletico Madrid Silence Barcelona for Camp Nou

Calvin Bassey challenges for the ball against Burnley

But no be only goal matter. Bassey full everywhere for pitch. Baba win 11 duels — match highest — dey bully attackers, dey calm with ball, show muscle and sense. Proper commander at the back.

That win give Fulham small breathing space from relegation wahala, while Burnley own problem just dey add extra chapters for Premier League survival story.

Chukwueze Dey Tune Body Before AFCON 2025

As Bassey dey hammer EPL attackers, Chukwueze too dey quietly cook for him side. Winger no dey shout, but him numbers dey talk.

  Collins Sor Lead Naija Ballers Abroad Wey Shine Wella, As Goals and Assist Scatter Europe

This season, Chukwueze don register six goal contributions — two goals and four assists in eight appearances. Direct football, sharp legs, defenders dey turn neck.

Him form dey sweet Super Eagles fans belle as AFCON 2025 dey near, even though club coaches dey already calculate how dem go survive without their stars.

Samuel Chukwueze in action ahead of AFCON 2025

Fulham coach Marco Silva go feel am well well too, as both Bassey and Chukwueze set to answer national call-up in coming weeks.

As e stand now, both men dey enter AFCON with full confidence: Bassey go bring concrete defense, Chukwueze go add pepper for attack. Na balance wey Nigeria need. Football don ready.

  Paul Onuachu, Oshoala tear net as Super Eagles, Super Falcons stars flex everywhere dis weekend
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on December 14, 2025 8:59 am by Hitvibz Media