Hull City defender Semi Ajayi don hala make Super Eagles raise their game, even after dem start their AFCON 2025 campaign with 2-1 win over Tanzania for Morocco.

Semi Ajayi Admits Super Eagles Need to Do Better After AFCON 2025 Opener

Di centre-back show correct leadership for backline and still knack one big goal wey set the tone for di match, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Semi Ajayi Dey Lead from Front for AFCON 2025 Opener

Di 32-year-old give Naija di lead on Tuesday night, jump high catch Alex Iwobi cross with strong header.

Semi Ajayi leads Super Eagles defence in AFCON opener

Na him first international goal be dat, and e still make am collect Man of di Match award later.

Reflecting on di moment, Ajayi talk say make everybody share di work in front goal as Super Eagles dey push for big run for AFCON 2025.

  Super Eagles don retain Unity Cup as Alhassan Yusuf scatter Jamaica plan to pay back

E sweet me wella to score for my country, and for game like this to start well, na correct feeling be dat,” e talk.

“I dey happy well. E show say we be one team wey no go just depend on attackers to score goals.

“I believe say we fit score from anywhere for pitch. Defenders, midfielders – everybody gats put hand if we wan shine for di tournament. I dey glad say we start well.”

Semi Ajayi says Super Eagles need to do vetter after 2-1 win over Tanzania

Semi Ajayi Point Out Wetin Super Eagles Gats Improve

Even though dem win, Semi Ajayi clear say Naija gats sharpen some parts of dia game before dem face Tunisia next for Group C.

  Paul Onuachu Don Enter Double Figures, Help Trabzonspor Win Again vs Konyaspor

Di former Arsenal defender yan say dem gats focus on game management as tournament dey go.

Some tins we fit improve, but plenty things still dey we fit take as positive from di game.

“Like I talk before, we sabi say some tins gats better, like how to control game finish well and finish team off. We go dey work hard for training make we fix am.”

Semi Ajayi says Super Eagles need to do vetter after 2-1 win over Tanzania

With Tanzania matter don clear, Super Eagles dey set eye on Tunisia, sabi say another win fit lock early knockout spot for AFCON 2025.

  Chidozie Awaziem: Heartbreak for Super Eagles Baller as Nantes Fall Enter Ligue 2

For Semi Ajayi, di message dey simple: correct start matter, but improvement go decide how far Naija fit reach.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on December 25, 2025 6:31 am by Hitvibz Media