Blackburn Rovers fans bin dey expect Emmanuel Dennis to shine when e enter second half against Norwich City. But instead of e usual sharp play, na red card matter full e name for headlines again.
My guy leave fufu and egusi soup wey em mates dey chop, go dey chop red card instead… Na wa oh!
Emmanuel Dennis chop red card, leave Blackburn for wahala
Match still dey balance when Dennis enter field for 62nd minute, replace Tyrhys Dolan for Ewood Park, Hitvibz reports.
But e no even last long before wahala start. Just five minutes after e enter, referee don flash am yellow card for one reckless tackle.
E still never learn, as 85th minute reach, Dennis commit another foul—this time inside box—catch Chrisene leg, and referee no waste time give am second yellow.
Na so e match end for am early, and e don add another bad record for Blackburn.
With Blackburn down to ten men, dem try hold Norwich but e no work. Just as match wan finish, Ante Crnac use one fine shot from center of box scatter their defense, after Emiliano Marcondes set am up.
E be like say Dennis wahala don cost Blackburn three points.
Last-minute goal save Blackburn from complete disgrace
Just when e be like say Norwich don carry all three points, Andreas Weimann use one bullet header equalise for 97th minute.
Na Yuri Ribeiro give am the assist, and na so Blackburn manage escape this kind yeye disgrace.
Even with the last-minute goal, Dennis’ red card don put am for problem as e go miss their next match against Derby County.
Blackburn sef never win their last two games, after dem chop 3-0 from Swansea before this 1-1 draw. Now, dem go need to bounce back—without the Nigerian forward.
Be the first to comment on "Emmanuel Dennis don leave fufu and egusi, go chop red card sharp-sharp—See how e take put Blackburn for wahala"