Omo, Naija striker Rafiu Durosinmi don make big move for him career as e don sign for Italian Serie A team, Pisa SC.

Rafiu Durosinmi signing contract with Pisa SC

Na for their social media dem announce am, and e dey historic because na record-breaking transfer be this one for the club, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Rafiu Durosinmi Level-Up: From Czech to Serie A Shaku

The 23-year-old striker waka from Czech champions Viktoria Plzen, wey him spend two seasons dey score 13 goals for 32 games for all competitions.

Na for Plzen 2–1 UEFA Europa League win against AS Roma him really show style, that goal make European big clubs start dey eye am.

Rafiu Durosinmi celebrates goal for Viktoria Plzeň

Dem talk say clubs like Benfica, Lazio, Stuttgart, and some English teams including West Ham dey show interest for am.

  Victor Osimhen Tear Net Two Times as Galatasaray Win 26th Turkish Lig Title

But Pisa no gree slack, dem move quick, settle with the player and Plzen, come tanda am for their attack line.

Record-Breaking Deal: Pisa Snap Nigerian Baller

This transfer make Durosinmi become the most expensive player wey Pisa don buy. Plzen collect €11 million plus some add-ons, and Rafiu sign four-year contract wey go last reach 2030.

  Super Eagles Abroad: Maduka Okoye Stand Gidigba, Orban and Imade Just Dey Run Things

Even though Pisa dey struggle for Serie A this season — na one win, nine loss, nine draws dem get — people dey see say Durosinmi fit ginger the team wella.

Rafiu Durosinmi celebrating after scoring in Czech Republic

E go join Inter Milan loanee and Super Eagles midfielder Ebenezer Akinsanmiro as dem dey try climb the table.

This move mean say Rafiu fit show him skills for one of Europe top five leagues and continue dey grow for him football journey.

  William Troost-Ekong fire em first goal as Al Ahli wire Al-Gharafa for sweet comeback
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on January 14, 2026 6:38 pm by Hitvibz Media