Naija baller David Idowu show mad skills Monday evening as im ginger him team Arda Kardzhali to wipe Botev Plovdiv 5-0 for Bulgarian First League match.David Idowu score one, come assist anoda goal for Arda’s big victory

 

Idowu enter from bench come score the third goal for the game, come still serve the fourth one, as Arda Kardzhali tear Botev Plovdiv 5-0 for Hristo Botev Stadium, na Footballrover carry the gist, na weytin hitvibz dey yan be dat.

David Idowu Spark 5-Goal Show for Arda Kardzhali

The 25-year-old defender no be the only Naija boy wey play this match. Abraham Ojo play 45 minutes for Botev after e replace Emil Martinov, and Emmanuel John enter for 84th minute for Henrique Jocu.

Wetin start like normal match come change gengen for 26th minute when Botev Plovdiv guy, Andrey Yordanov, chop straight red card, make dem remain 10 for field.

Arda Kardzhali kuku dominate 9-man Botev Plovdiv for 5-0 win

 

  Philip Otele Still Dey Hot As FC Basel Wipe Young Boys 4-1 for Swiss League

Arda no waste time—dem quickly sub Serkan Yusein comot, come put the naija boy Idowu

Just one minute later, Dimitar Velkovski shock the home fans with better direct free kick wey open the goals.

Arda think say dem don score second goal as Calal Huseynov put ball inside net, but VAR come block am say na offside.

But Arda no stop to press. Just before halftime, Antonio Vutov make am 2-0 as e cooly finish pass from Lachezar Kotev.

Botev Fall as Arda Increase the Fire

Botev wahala worse for second half when captain Ivelin Popov collect second yellow plus red card for 58th minute—na 9 dem remain.

  Elijah Odede Turn Sheriff Goal Machine as Olakunle Olusegun Drop Him Own Goal for Russia

David Idowu dey celebrate em goal for Arda Kardzhali vs Botev Plovdiv

 

From there, the floodgates open. For 68th minute, Idowu score after correct assist from Svetoslav Kovachev—na him second goal in two matches be that.

He don score against HJK Helsinki for their last Europa Conference League match.

The Naija defender come turn assist king for 86th minute, give pass to Isnaba Mane wey knock in Arda fourth goal.

Three minutes later, Mane return the favour, set Birsent Karagaren wey nod better header to seal the 5-0 demolish.

Na big disgrace for Botev and mad statement from Arda, as dem show five-star performance for this Round 3 game for Bulgarian First Professional League.

Idowu don help the team grab their first win of the season after one draw and one loss for their first two games.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on August 5, 2025 9:31 am by Hitvibz Media