Na real gbege Samson Iyede go face for office like dis so oh! wey even as e manage score one goal, em still dey watch im team, Novi Pazar, collect small home beating from IMT Novi Beograd for dia Serbia Superliga match.
Di Monday night ball for Gradski Stadion na where di 27-year-old Naija baller knock equaliser wey bring dem back into di game, but las las Novi Pazar still chop 2-1 loss for dying minutes, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Samson Iyede Equaliser No Do As Novi Pazar Fall Yakata Late
Na game wey Iyede and im boys suppose win, as dem control 65% ball and knock 15 shots go IMT goal, wey only hold 35% possession and fire 14 shots.
Even as Samson Iyede enter headline with hin goal, hin Naija brother Ejike Opara sef run small for di game before dem comot am and put Abdulsamed Abdullahi just after second half start.
After small shakey beginning for di Mozzart Bet Super Liga Round 3 match, na IMT wey first draw blood as Milos Jovic score for 35th minute, hold am till halftime.
Second half na pure defensive war until 88th minute when Iyede link up with Italian guy Bob Omoregbe, dem combine well to balance score.
But just as everybody dey reason say di two sides go carry one point go house, na that time home team go do yama-yama give away penalty.
Vasilije Novicic first miss di 94th minute penalty, but e still jam di rebound inside net, collect full 3 points for IMT.
Novi Still Dey Find Dem First Win
This one mean say na back-to-back loss for Iyede and hin squad, after dem bin chop 3-1 beating for Conference League from Jagiellonia, wey pursue dem comot from Europe.
Novi never smell any win for league, as dem first match end 2-2 draw with Napredak.
Now dem go try stand gidigba when dem jam Radnicki Nis next, make dem find first 3 points sharp sharp.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on August 5, 2025 9:34 am by Hitvibz Media



Stay connected