Yusuf Otubanjo don ready for new waka — and this time na with FC Nasaf, wey be top team for Uzbekistan Super League.
Di Naija striker, wey sabi score like mad and dey run like jet, don sign one and half year contract after six seasons full of goals for Armenia, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Him no just waka comot quietly — di guy leave legacy for Ararat-Armenia and especially FC Pyunik, where e turn di highest foreign goal scorer for di club.
Dis move land few weeks after e score two correct goals wey help Pyunik qualify for next round of UEFA Europa Conference League.
Now, Otubanjo dey enter new level with di champions of Uzbekistan.
Yusuf Otubanjo Carry Him Goal Form Enter Uzbekistan
Di 32-year-old baller no dey carry last at all. For Armenia, Otubanjo scatter Marcos Pizzeli record as e knack 36 league goals — make am di highest foreign scorer for di league history.
Over 187 matches, di guy don deliver 88 goals and 23 assists — guy steady like power bank.
As e talk to FC Nasaf fans, e yarn:
“I dey happy say I don join this correct team. Make una ready — we go win trophies together. I dey wait to see all di fans — we go soon meet.”
E stand 177 cm and weigh 70 kg — Otubanjo sabi mix sharp brain with better movement.
Before now, e don rep Naija U-17 and play ball for many obodo like Spain, Austria, Slovakia, and Armenia.
Clubs wey e don play for include:
Atletico Madrid C
RB Salzburg
FC Pasching
FC Blau Weiß Linz
MŠK Žilina
SCR Altach
LASK
Ararat-Armenia
FC Pyunik
All di experience wey e carry now go ginger Nasaf as dem dey chase more trophies for home and for Asia side.
FC Nasaf Dey Add More Fire Before Big Wahala for League and Asia Tourney
FC Nasaf, wey dem build for 1997 and dey based for Qarshi, na one of di top clubs for Uzbekistan.
Dem don win plenty tins like Uzbekistan Cup (2015) and even the AFC Cup (2011). Dem dey always carry medal for league and don qualify enter AFC Champions League.
To sign Otubanjo mean say dem no dey play — dem wan goals and title by fire by force.
As for Otubanjo, e talk say this move no be anyhow waka — na well-think move wey time don ripe.
For him goodbye message to Armenia, e yarn:
“Plenty people fit dey ask why I comot, but for now, I just wan thank una wella. Armenia really show me love. I appreciate everything.”
“Thank you Ararat-Armenia, una give me humble beginning and make the place feel like home. Pyunik, I no even fit put am for words… One wise man tell me say, when di time reach, you go know and do wetin go better for you.”
Now, time don reach — and Otubanjo dey set to shake everywhere for Uzbekistan with FC Nasaf.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on July 30, 2025 4:27 pm by Hitvibz Media


Stay connected