Naija baller Chidera Michael Okoh don complete permanent transfer from Greek Super League club Asteras Aktor go Bulgarian top-flight side Botev Plovdiv, as e become the seventh player wey the Canaries sign this summer transfer window.
Botev confirm the arrival of the 23-year-old striker for dia official social media pages as dem reveal say dem pay undisclosed transfer fee to Asteras Aktor to complete the deal, na weytin Hitvibz dey yan be dat.
Chidera Okoh Don Join Botev Plovdiv on Permanent Transfer
As part of the move, dem don hand Okoh the club’s famous No. 9 jersey as e dey prepare to start fresh chapter for Bulgaria.
As dem announce the transfer, the Bulgarian club write:
“Botev Plovdiv don strengthen dia attacking option with Chidera Okoh. The naija striker na di seventh player wey don join the Canaries’ summer squad.”
Asteras Aktor too confirm say Okoh don leave the club, as dem thank the Nigerian striker for everything wey e contribute during him two years with the senior team and B team, while dem wish am success for the next stage of him career.
Who Be Chidera Okoh?
Chidera Michael Okoh, wey dem born for April 5, 2003 for Enugu State, Nigeria, na 1.93-metre centre-forward wey people sabi for him strong aerial ability, physical strength and the way e fit lead attack like classic No. 9.
The right-footed striker start him European football journey with Czech Republic club Slovan Liberec before e move go Maltese side Mosta, where him goals help am attract interest from clubs across Europe.
From there, Okoh move go Greece join Asteras Aktor, where e play for both the senior team and reserve side as e continue to develop him game.
For the 2025/26 season, Okoh play 19 senior matches across all competitions for Asteras Aktor and score two goals before e secure him move to Bulgaria.
Since e begin him senior career, the Nigerian don make more than 30 appearances across Czech Republic, Malta and Greece, gradually building name for himself as one strong striker wey sabi trouble defenders.
This move to Botev Plovdiv give Okoh another big chance to prove himself for European football, and the Bulgarian club don already show plenty confidence for am by handing am the famous No. 9 jersey.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on June 30, 2026 11:11 am by Hitvibz Media
Related
Chidera Okoh Don Complete Permanent Transfer Go Botev Plovdiv as Bulgarian Club Sign Naija Baller



Stay connected