Omo, our Super Falcons babe, Vivian Ikechukwu, dey run things for Mexico o. The geh don turn goal machine for Club Santos Laguna.
Again again she nack double goals as dem jam UNAM Pumas Women. The match na real 8-goal gbas gbos. But as usual, her goals still no save dem, na weytin hitvibz yan be dat
Final score: Santos chop 5-3 for dia own backyard, Estadio Corona. Shame catch dem fans.
Vivian Ikechukwu Brace Sweet, But E No Save Them
See gist: Ikechukwu don dey do back-to-back-to-back scoring. Third straight game wey she dey find net. Four goals in eight matches.
Levels. But wahala be say, anytime she score, the team dey lose. Na like say her goals na bad luck charm. Na Rivers Angels product o, no be today she sabi ball.
But these her new teammates dey play like dem dey do trial for NTA drama. Four straight losses don follow dem, only small 2-1 escape win against Chivas dey inside last five games. Na relegation form be dat.
Match Wey Be Pure Nollywood
No be match, na film trick! From the 8th minute, fire don start. Stephanie Ribeiro open book for Pumas.
Before dem fit even drink water, Vivian Ikechukwu equalize one minute later. By 12th minute, Bolaños reply back — 2-1. Ikechukwu no gree, she balance am again for 22nd minute.
Second half? Na pure street fight. Ribeiro grab her second, Santos later chop late own goal wey favour dem equalize 3-3. Fans don dey hope say “e go end draw, at least e better.”
But wahala never finish. 78th minute, own goal. 90th minute, red card enter like referee dey vex. As dem reduce to 10, Ribeiro knack hat-trick for stoppage time, Ximena Ríos just seal coffin two minutes later. Final blow. 5-3.
Guy, na full-season drama package: red card, hat-trick, own goal, comeback — everything wey dey make person lose voice for viewing centre.
Santos Dey Sink Like Chelsea Weh No Get Drogba
This kind heavy beating don push Santos ladies near bottom. Dem dey 15th out of 18, just one point clear of relegation water. Fans dey already ask: “Na relegation zone una dey hustle enter abi una dey play ball?”
Next up, dem go jam Necaxa on Friday. If dem no gree wake up, Necaxa fit just use dem do training session. For Ikechukwu, no wahala — she dey shine her shine. But for her teammates? Baba, dem need serious deliverance.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on September 3, 2025 4:19 pm by Hitvibz Media




Stay connected