From Switzerland come go reach Libya, from UEFA Conference League down to small leagues for England, Naija ballers burst field this weekend with mad goals and assists wey deserve kudos.

Umeh Emmanuel Dey ball

Whether na Umeh Emmanuel wey knack late equaliser for FC Zurich or Gabriel Orok Ibitham wey carry show for Libya with one goal and one assist, dis Naija ballers dey prove say talents from our country dey shine anyhow for every corner of di world, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Umeh Emmanuel Save One Point for FC Zurich

For Swiss Super League, 20-year-old Umeh Emmanuel enter from bench come fire one correct equaliser for FC Zurich as dem play 1-1 draw away against Luzern for Swissporarena on Sunday.

Umeh Emmanuel Dey Front as Naija Ballers Scatter Europe with Goals Like Fireworks

Di goal happen just six minutes after di home team score first, na serious impact e make and e show why Umeh Emmanuel don come become one of di Naija ballers we suppose watch dis season.

Abdullahi Bewene Drop Two Assists for Czech Republic

Abdullahi Bewene burst fire for Banik Ostrava B for Czech Liga 2, as e deliver two hot assists for their 5-0 home win against Artis Brno.

  Simeon Nwankwo Don Run Am Again! Him 5th Serie B Goal Help Salernitana Win, Send Cittadella Go Relegation

Abdullahi Bewene

Di 20-year-old midfielder give dem di fourth and fifth goal on Sunday, help dem waka pass Round 4 for Mestsky Stadion.

Kingsley Iheme Score Winning Goal for FK Slovan Duso

For Slovakia 3 Liga, veteran striker Kingsley Iheme show say age na just number as di 33-year-old knack winning goal for FK Slovan Duso 4-3 win over Senec on Sunday.

Kingsley Iheme

Na him goal complete comeback and secure full 3 points as em join di list of Naija ballers wey delivered wen dia clubs need dem wella.

Sadiq Saleh Still Dey Score for Latvia

Sadiq Saleh na di man wey score di only goal for FS Metta as dem beat FK Auda 1-0 away for Latvian Virsliga.

Sadiq Saleh

Di goal wey e knack for 48th minute inside Skonto Stadium don carry di team go 4th for table. Na him second straight goal be that.

Salim Fago Lawal Give Assist for NK Istra

Even though dem lose 2-1 to Hajduk Split, Salim Fago Lawal still drop one assist for NK Istra for Croatia HNL on Sunday.

  Henry Onyekuru dey happy say e join Gençlerbirliği: "Na my padi make me reason am"

Salim Fago Lawal

Di 22-year-old give assist for di equaliser and play 65 minutes for Poljud, but dem still fall to 7th for league table.

Sunday Akinbule Score for Al Akhdar for Libya

Sunday Akinbule score second goal for SL Akhdar SC as dem draw 2-2 away with Al Hilal for Libyan Premier League Championship Round (Matchday 3) on Saturday.

Sunday Akinbule

E score for 44th minute help dem carry one point inside serious match.

Gabriel Orok Ibitham Show Class for Al Ahly Benghazi

Gabriel Orok Ibitham burst everywhere for Al Ahly Benghazi, e score one goal and assist another one for their 2-0 away win against Al Swehly.

Gabriel Orok Ibitham

Di 24-year-old score for 74th minute, then come drop assist for added time. E collect Man of the Match sharp sharp. Did tin show say even for North Africa, you no fit just ignore Naija Ballers.

Idowu David Akintola Score for Europe Battle

For UEFA Conference League qualifiers, Idowu David Akintola open scoring for FC Arda for their 2-2 draw (wey later turn 4-3 win for penalties) against HJK Helsinki.

  William Agada Help Real Salt Lake Scatter Club América, As Kparobo Arierhi Score Em First Goal

Idowu David Akintola

Di 25-year-old score for 24th minute. Even though dem lose lead, dem still win for shootout for Bolt Arena.

Daniel Udoh Score Consolation for Wycombe

For England League One, Daniel Udoh score for 68th minute for Wycombe Wanderers but dem still lose 2-1 away to Bradford on Saturday.

daniel udoh

Di 28-year-old striker goal no fit save dem, as Chairboys still dey 17th for league table.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on August 4, 2025 10:34 am by Hitvibz Media