Naija pikin Hafız Ibrahim do correct show on Saturday night, score di winning goal as Stade de Reims knack hard-fought home W over Saint-Étienne for French Ligue 2.

Hafız Ibrahim in action for Reims

Di 20-year-old knack di only goal for di match, make Reims win 1–0 for Stade Auguste-Delaune, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Hafız Ibrahim Shine as Reims Sharp Saint-Étienne

With dat goal, Ibrahim don reach six goal involvement for di season so far – five goals plus one assist.

  Hafiz Ibrahim 6th goal no fit save Reims as Daniel Udoh carry Salford for head like dada

Ibrahim play 76 minutes before dem comot am make Adama Bojang enter, just six minutes after Ibrahim knack di winner.

Hafız Ibrahim scores winning goal for Reims in Ligue 2

Before dat goal, gbege happen for 55th minute as Ange Tia collect second yellow make dem show am di red card. First yellow na just ten minutes wey game don start.

Reims Show Grit Despite Red Card Wahala

Dis one reduce di home team to ten men for di rest of di match.

Even with dat wahala, Reims hold ground, show correct fighting spirit, secure di win and carry all three points.

  Hafiz Ibrahim 6th goal no fit save Reims as Daniel Udoh carry Salford for head like dada

Hafız Ibrahim in action for Reims at Stade Auguste-Delaune

Dis win put Ibrahim and him teammates for third place with 35 points, six points behind league leaders Troyes, as dem dey ginger prepare for next game against Clermont Foot next Friday.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on January 25, 2026 10:09 am by Hitvibz Media