Super Eagles striker Akor Adams continue him hot form on Saturday as he nack the winning goal for Sevilla wey beat Athletic Bilbao 2-1 for La Liga.

Akor Adams scores penalty for Sevilla in La Liga clash

The Naija striker score when e matter pass, help Sevilla grab important win for house, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Akor Adams Na The Difference Maker

Even though Adams touch ball just 29 times for the whole 90 minutes – na the least for any outfield player – e still show say e sabi ball well well. Calm, sharp, and clinical. Na why Sevilla dey trust am for big-big moments.

  Yakubu Ayegbeni Don Warn: Carry Siasia, Eguavoen throwey from Super Eagles — "That Era Don Pass"

Now Adams don score for two straight league matches for Sevilla. For him last two games, e don bag three goals, after him score two against Elche for the 2-2 draw.

Athletic Bilbao open scoring for 40th minute when Robert Navarro push ball enter net from close range.

Super Eagles star Akor Adams in action for Sevilla during La Liga match_

But Sevilla no waste time reply, as Gerard Fernández level am two minutes later with low shot wey beat goalkeeper.

Adams Push Sevilla Forward for La Liga

For 56th minute, Adams carry shoulder step up take penalty, coolly slot am inside net, scatter stadium, and seal comeback win for Sevilla.

  Super Eagles Victor Osimhen Knack 13th Goal, Carry Galatasaray Win After AFCON Bronze

The match na Adams 15th La Liga game for Sevilla this season. So far, e don contribute five goals and two assists.

Akor Adams in action for Sevilla during La Liga match_

Another Naija boy, Chidera Ejuke, enter late for the game as e come on for 81st minute replace Isaac Romero. Na him 13th appearance for the club this season.

Short story: Akor Adams no too touch ball, but anytime e touch am, na problem for defenders.

  Victor Osimhen Land 200 Career Goals as Galatasaray Scatter Kayserispor 4–0
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on January 24, 2026 11:24 pm by Hitvibz Media