Na our own Naija striker Stephen Alfred dey show him class for Europe as e knack the kain goal wey carry Torpedo Zhodino enter next round for Europa Conference League qualifiers.

Stephen Alfred dey celebrate em Europa Conference League goal

For serious match wey happen for Toše Proeski Arena, Alfred no waste time – na him early goal give dem the 1-0 win wey dem need take comot Rabotnicki for house, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Torpedo win the first leg 3-0, so this one na finish work.

Stephen Alfred No Waste Time – E Burst Net Sharp-Sharp

At just 14 minutes into the second leg, the 27-year-old baller use one sharp pass from Pavel Sedko slot the ball enter net like breeze.

Naija striker Stephen Alfred dey enjoy Europa Conference League action

That goal na the only one for the whole game, but e do the job correct.

  Elijah Odede Still Dey Shine Small-Small As FC Sheriff Comot For Europa League

For the first leg too, Alfred still score last-last goal for injury time, so na back-to-back goal he dey give dem now. E don show say him na real G for that team.

Torpedo Don Ready for Bigger Wahala – Maccabi Haifa Dey Wait

Torpedo Zhodino’s Stephen Alfred don score vs Rabotnicki

With 4-0 total score, Torpedo Zhodino don qualify enter next round of the Europa Conference League wey dem go jam Maccabi Haifa from Israel on top July 24.

  Chidera Nwoga Still Carry Transinvest Dey Fly as Olaoluwa Ojetunde Help Ravshan Draw

The match go tough pass the last one, but with Alfred on fire like this, confidence full ground for Torpedo side.

No be say na only goal e dey score – the guy dey write European story wey make sense pass Nollywood script.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on July 18, 2025 11:47 am by Hitvibz Media