Two Naija ballers, Jesse Sekidika and Luqman Gilmore, burst enter spotlight Thursday night as dem drop better assist for dia club dem inside UEFA Europa League and Europa Conference League qualification match.
One of dem enter tough game wey kuku end 3-3, the other finish work sharp-sharp carry em club go next round like b
oss, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Sekidika Light Up Comeback for Sabah Baku Inside 6-Goal Wahala
For Slovenia, inside Arena Petrol, Jesse Sekidika enter pitch from bench for 59th minute as Sabah Baku dey trail 2-1 against NK Celje for Europa League Qualifiers.
No waste time at all — just 4 minutes later, Sekidika knack beta assist give Joy-Lance Mickels make e level the match 2-2. Baba show say im get eye and leg correct.
The match later end 3-3, but because Sabah lose first leg 3-2, dem still comot with 6-5 for aggregate. E pain, but Sekidika show levels say e fit still shine for Europe later.
Gilmore Control Midfield as Paide Scatter Magpies
Over for Estonia, Luqman Gilmore run the show wella as im help Paide Linnameeskond knack 4-1 beat down on Magpies from Gibraltar for Conference League Qualifiers.
Gilmore play full 90 minutes like warrior, control midfield like landlord, and even drop clean assist give Pa Corr make e score him second goal.
That na the third goal before Pa Abdou Cham seal the matter with number four.
With that win, Paide waka go next round with 7-3 for agg, after dem don first win first leg 3-2.
Gilmore wey be 29, show say Naija midfield dey soft with am.
Both Sekidika and Gilmore prove say dem still be solid material for any team. But as e be, Sekidika try but e no reach save Sabah Baku, while Gilmore flex enter next stage with style.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on July 18, 2025 11:09 am by Hitvibz Media




Stay connected