Naija baller, Prosper Obah, don turn Ukrainian Premier League champion wit Shakhtar Donetsk. Dis one hapun after d club beat Obolon Kyiv 3-1 for house on Wednesday.
Shakhtar lock d title wit 69 points, and dem gap LNZ Cherkasy wey dey second position wit 12 points. Di champions win 21 matches, draw six, and na only one match dem lose out of 28 games, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Prosper Obah win Ukrainian Premier League wit Shakhtar
Di 22-year-old Naija attacker carry him first Ukrainian Premier League title even though two matches still remain to end di 2025/26 season.
E be like say things really gel for Prosper Obah dis season, as him record show say:
⚽ 9 goals
🎯 3 assists
📊 12 goal contributions
Obah score him number 8 league goal for di season when Shakhtar wire Zorya Luhansk 2-1 for away on April 23.
But since him enter Shakhtar during di winter transfer window, na only dat one goal contribution him get for di club.
Things no too easy for di Naija boy to get regular playing time after di move. Him only play nine matches and total time wey him spend for pitch just small pass 400 minutes. Dem also leave am for bench for eight games.
Obah shine even though him no play many games for Shakhtar
Most of Obah goals and assists hapun when him still dey LNZ Cherkasy for di beginning of di season, after him sign for dem during summer transfer.
Him score eight league goals for Cherkasy and add one more for Ukrainian Cup.
One big moment for him season na when him score and give assist for di heavy 4-1 win wey Cherkasy win against him current club, Shakhtar Donetsk.
Even though him no play many minutes after him transfer, Obah still finish for 10th position for di Ukrainian Premier League highest goal scorer chart.
Him Naija brother, Peter Itodo, look like say him go finish for third place wit 10 goals for Metalist 1925.
Obah start him career for Europe wit FC Vizela, where him score five goals for 32 matches.
Di young striker still dey find dat blow season for Europe and him go dey hope say him go play more games for Shakhtar Donetsk next season.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on May 15, 2026 10:46 am by Hitvibz Media
Related
Prosper Obah don carry Ukrainian Premier League trophy for Shakhtar Donetsk after him serious runs




Stay connected