Omo! Philip Otele no wan calm down o – e don burst net again as e carry FC Basel for shoulder, help dem win Grasshopper for hot Swiss Super League match wey happen dis Saturday evening.
Philip Otele Finish Work for St. Jakob-Park with Two Correct Goals
Na Round 2 for Swiss Super League and Otele no waste time – the Naija baller show say him leg still hot as ever for St. Jakob-Park, Switzerland, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Last season, Otele knack 9 goals plus 4 assists in just 18 matches for Basel. This season? The guy don even turn beast.
First half almost end when Otele jam better pass from Dominik Schmid, compose himself, and calmly put am for net. Just like that, Basel carry 1-0 go halftime.
Second half never too go far when Grasshopper respond – na Maksim Paskotsi find equaliser for 69th minute.
But Otele no gree. Just six minutes later, the 26-year-old striker yan “hold my drink” – boom! Another goal. Basel 2, Grasshopper 1.
€3 Million Baller Dey Show Say E Worth Every Kobo
Just before full time reach, Basel gaffer comot Otele give am rest, make Koba Koindredi enter.
Basel manage hold the lead till final whistle blow – collect the three points sharply.
After dem lose 2-1 to St. Gallen for season opener, this win na serious morale boost as dem dey chase league title again.
Otele matter for Basel dey sweet like new gist. For him last match sef, e score for comeback win over FC Rapperswil-Jona (4-2) after e return from Al Wahda. That €3 million wey Basel pay to bring am back? E dey pay off already.
Now, the guy don do am again – two goals, three points, confidence dey rise. If e continue like this, this season fit be Otele best one yet.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on August 2, 2025 10:18 pm by Hitvibz Media



Stay connected