Baba no dey joke again o! Abdulrahman Taiwo don turn goal machine for Slovakia as e knack better hat-trick wey carry Spartak Trnava waka comfortably beat AS Trenčín 4–0 for Niké Liga.
The Naija striker just dey hot like generator wey no wan off — e performance for Štadión Antona Malatinského make people shout “Wetin this guy dey chop sef?”
Spartak don now bag back-to-back wins and Taiwo name dey all the headlines like say na him be Messi cousin, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Abdulrahman Taiwo Lead Spartak Trnava Ruthless Wahala
Omo, no be small thing. Taiwo no even wait make match settle — just two minutes in, e show say e mean business. Sharp movement, one small shift, defenders freeze like mannequin challenge, gbam! First goal don enter.
Before Trenčín fit breathe, wahala double. Na Procházka free kick cause gbege as Fedor Kasan mistakenly nod am enter him own net. Spartak don dey control the show early like say dem dey play training match.
Second half come be like Taiwo personal YouTube highlight reel. For 53rd minute, Hilary Gong — another Naija baller — carry ball run counter, drop one sweet assist wey make Taiwo just bend low, shoot am neat near post. Keeper Húdok no even see road.
Then 66th minute, Taiwo finish the assignment. Boom! Close-range header — hat-trick complete.
Stadium scatter! Fans dey scream, beer dey pour, everybody dey hail the 25-year-old baller wey don now score five goals in just five games.
Naija Boys Dey Run Things for Slovakia
But make we no lie — Taiwo no do am alone. Hilary Gong, that same guy wey don play for Trenčín before, dey ball steady this season.
The guy don collect one goal, two assists already, and him even give Taiwo one sugar pass for the second goal.
Another Naija blood, Philip Azango, also enter for 68th minute replace Timotej Kudicka. Even though e no play long, the guy still show small pepper, combine well for attack.
Taiwo later comot for 77th minute make Luka Khorkheli stretch leg small, but at that point, e don already lock the three points inside cooler.
Spartak climb go fourth for Niké Liga table while poor Trenčín still dey waka with seven straight matches without win since August — na wah o.
After match, Trenčín coach Ricardo Moniz come reason the matter. The man just dey shake head like person wey remember ex.
“We no get players like those Naija boys again,” e talk. “Spartak get quality with Gong and Azango — both don pass through here before.”
Omo, e pain am sha. But as we go talk for Naija: if you no fit beat them, na to just respect their hustle remain.
Taiwo and him boys don turn Slovakia to small Naija Premier League — dem dey ball, dem dey score, dem dey enjoy life.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on November 4, 2025 9:46 pm by Hitvibz Media






Be the first to comment on "Abdulrahman Taiwo burst net with hat-trick, Gong serve assist, Azango Shine – Naija boys run things for Niké Liga"