Hamburg new boy, Philip Otele, don yan the kind words wey dem give am wey help am settle for him Bundesliga debut, after him shine for first match against Heidenheim.

Philip Otele in action during Bundesliga debut

Di Naija striker make correct impact sharp-sharp after him winter loan from Basel, help Hamburg collect important 2–0 win, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Philip Otele yan the advice wey guide him Bundesliga debut

The 26-year-old play 68 minutes as Hamburg secure their first league W for this year.

Na im be club most dangerous attacker, Otele fire three shots for target and deliver assist for Ransford Königsdörffer opening goal deep inside first-half added time.

As e dey reflect on the words wey head coach Merlin Polzin and him staff give am before kickoff, Otele talk say the message clear well-well.

  Ex-Super Eagles Captain William Troost-Ekong Don Join Al Ahli to Help Dem Survive for Qatar Stars League

Philip Otele celebrates assist for Hamburg vs Heidenheim

I don dey craze to play Bundesliga from before. Coach dem tell me wetin I suppose do. Make I stay connected, dey push forward, show my strengths. But the main thing be say make I enjoy myself.”

Na those instructions make am shine quick, as Otele play with confidence and style for him Bundesliga debut against Heidenheim.

Otele yan how e prepare before joining Hamburg

Otele still reveal say him decision to join Hamburg no be by chance. Before e complete move from Basel, the Naija forward run check with other players and study the club properly.

  Super Eagles baller Umar Sadiq don set yeye record for Copa del Rey after e score own goal, still score equaliser

“I yan with plenty players. Dem all yan only correct thing. I watch some YouTube videos of the team. Even videos of fans. Na there I reason say: Okay, this club dey really gbaski.”

That small research help am settle sharp-sharp, Otele don quickly adapt life for Hamburg and dey respond well to the trust wey dem get for am.

Philip Otele makes Bundesliga debut for Hamburg

Before now, e dey Nigeria provisional AFCON 2025 squad but miss final selection. Now, Otele go dey focus to build solid Bundesliga career as e continue him journey with Hamburg.

  Paul Onuachu Dey Feel Am: Everything Wey Em Talk as Trabzonspor Begin Season With Fine Win
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on February 9, 2026 7:59 am by Hitvibz Media