Super Eagles no fit keep de winning streak dem get during de international break, as dem draw 2-2 with Jordan for one correct match wey happen for Tuesday evening for Antalya.
Even though Naija fight come back from behind come take lead, dem no fit hold de victory till final whistle, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Simon and Fernandez Try Save Di Day for Super Eagles
After dem win Iran 2-1 last weekend, goals from Moses Simon and Emmanuel Fernandez no reach to give Eric Chelle boys back-to-back win.
But as the match start, e no follow plan at all. Jordan take the lead just 17 minutes into the game after Mousa Tamari score one fine free-kick wey pass Francis Uzoho enter net.
Six minutes later, Nigeria think say dem don equalize when Raphael Onyedika score from one cut-back wey Moses Simon give am, but the referee come cancel the goal say na offside.
The joy finally come for the 26th minute. Ademola Lookman shoot, but the ball block; luckily, Moses Simon dey active for inside box, he quick react and fire the rebound enter net to make the score 1-1.
Before the first half for finish, Emmanuel Fernandez, who dey play his first start for the national team, decide to show him class.
The Rangers defender control one cross wey Bright Osayi-Samuel give am, come fire one left-foot shot pass the Jordan goalkeeper legs enter net. That one make the score 2-1 before halftime.
Iwobi chop red as Jordan try put fear for Nigeria body
For the second half, the game come calm down small, but Nigeria get bad news for goal.
Twelve minutes after the second half start, Francis Uzoho fall down as he clear ball, injury gas am and he comot for pitch. Adebayo Adeleye enter to see if he fit help dem hold the win.
Things change for 77th minute when Mohammad Al Daoud score, he draw the game for Jordan and the score come be 2-2.
As dem dey find that winning goal for die-minute, Coach Chelle bring in Phillip Otele (weay just dey play him first match) to replace Frank Onyeka with nine minutes left, while Samuel Chukwueze replace Moses Simon.
But even with all the tactical change, the goal no gree come. To make mata worse, Alex Iwobi collect red card for added time, and na so the match end for draw as referee blow final whistle.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on March 31, 2026 9:11 pm by Hitvibz Media



Stay connected