Super Eagles forward Anayo Iwuala show mad performance on Wednesday, as e score one goal and still give assist for Al Arabi for their Super Cup semi-final match.

Super Eagles forward Anayo Iwuala scores for Al Arabi

But even with the way e ball, the Nigerian winger still end the night with heartbreak, as e effort no fit carry Al Arabi enter final after dem waste strong lead, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Anayo Iwuala ginger Al Arabi early early

Iwuala open scoring sharp sharp and later set up second goal for him team, but na from sideline e watch as Al-Arabi throway two-goal lead.

  Calvin Bassey: Why Fulham coach Silva dey bench Super Eagles star after AFCON return

Al-Qadsia come back strong, knock Iwuala and him teammates commot for competition with painful 4–3 loss.

Al-Qadsia shock Al-Arabi for seven-goal banger wey decide late late for hot Kuwait Super Cup semi-final.

Match no waste time catch fire, as Mobarak Al-Faneni score inside first minute.

Anayo Iwuala scores for Al Arabi in Super Cup Semi Final clash

Al-Arabi answer quick quick, as Anayo Iwuala score just two minutes later. Ref first wave am for offside, but VAR check am and confirm say na correct goal.

  Simy Nwankwo don nack 25 goals for Saudi First Division as Peter Itodo wire him ninth goal for Metalist

Al-Qadsia run full comeback for Super Cup

Ten minutes later, Komail Al-Aswad put Al-Arabi back for front make e 2–1, before Hassimi Fadiga add another one three minutes later to make am 3–1.

But Al-Qadsia no panic. After halftime, dem arrange demself and start comeback. Moaath Al Dhafiri score for 58th minute reduce the gap.

Anayo Iwuala celebrating his goal for Al Arabi in Super Cup Semi Final

Drama full ground late late as Abdullah Al-Awadhi equalise with six minutes remain.

For 98th minute, veteran Bader Al-Mutawa show class, calmly score penalty seal big comeback and carry Al-Qadsia enter Super Cup final.

  Super Eagles Future Pikin Rafiu Durosinmi Fire First Shot as Plzen Chop 2-1 Win
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on January 29, 2026 7:52 am by Hitvibz Media