Super Eagles star baller, Victor Osimhen, don carry him beta form enter Galatasaray match dis weekend.

Super Eagles star Victor Osimhen in action at RAMS Park for Galatasaray

Di guy score again as him team nack Başakşehir 3-0 for RAMS Park, and dis win don make dia hope to carry di trophy again strong wella, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Victor Osimhen Show Him Power vs Başakşehir

Dis goal mean say Osimhen don score for three Super Lig match back-to-back, after him been don show Alanyaspor and Beşiktaş pepper.

Di 27-year-old Naija boy don get 12 league goals and 4 assists dis season. If you count all di competition wey him play, him don get 24 goal contributions—join di 7 goals and 1 assist wey him don fire for UEFA Champions League.

Galatasaray forward Victor Osimhen controlling the ball during a Turkish Super Lig match

Even though him play well, di coach change am for 75th minute make Mauro Icardi enter. As him dey commot, di whole stadium stand up dey clap for am.

  Philip Otele don prove him Super Eagles worth as Dortmund do Hamburger dirty for Bundesliga

Super Lig Title Race: Galatasaray Don Give Dem 7 Points Gap

Başakşehir try defend for first half, but as second half start, Galatasaray change am for dem.

Di first goal enter for 52nd minute after Noa Lang play fine free-kick give Wilfried Singo, wey just fire di ball enter top corner.

Things con bad for di away team as Festy Ebosele collect second yellow card commot for pitch. With ten men, Başakşehir no fit breathe again.

  Super Eagles star Frank Onyeka don talk why Coventry City be like him home since day one

Galatasaray use di chance sharp-sharp. Nine minutes later, Osimhen collect better cross from Yunus Akgün, control am like person wey sabi, con finish am “gbam” into di net to make am 2-0.

According to OptaCan, the Super Eagles man don become the first player since dem start to keep record wey don score or give assist for nine Super Lig matches back-to-back.

Before match finish, Akgün con give Renato Nhaga another better pass for 84th minute. Nhaga no waste time, him just cool down wire di goalkeeper to make am 3-0.

Victor Osimhen celebrating his 12th Super Lig goal for Galatasaray against Başakşehir

With dis win, Osimhen and em teammates never lose for 5 matches straight. Now, dem don get 7 points gap for top of di table after 26 matches.

  Akor Adams Serve First Sevilla Assist, But Athletic Club Burst Dem Comeback Party

Dem get match with Göztepe for midweek before dem travel go Anfield go face Liverpool for Champions League.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on March 15, 2026 4:43 am by Hitvibz Media