Cyriel Dessers don end season with goals for 5 straight games as Rangers finish with gbas gbos

Super Eagles forward Cyriel Dessers
Share this

Super Eagles striker Cyriel Dessers dey hot like fire right now, as im knack another correct goal against Hibernian to help Rangers close their Scottish Premiership season with better style.

Cyriel Dessers don end season with goals for straight games as Rangers finish with gbas gbos

Na just two minutes into the match for Easter Road for Saturday afternoon, Dessers use him right leg deliver one clean finish enter bottom left corner after Nicolas Raskin head the ball give am, Hitvibz reports.

Em early goal na em kuku ginger Rangers for the 2-2 draw wey later turn to gbas gbos.

Cyriel Dessers No Dey Joke — 5th Straight goals for Rangers

After em help Rangers come back beat Dundee United 3-1 for Ibrox midweek, Cyriel Dessers show again say na him dey run things.

Him goal against Hibernian mean say em don score 29 goals and give 6 assists this season for all competitions.

That one don pass wetin he do last season—22 goals and 7 assists in 54 matches.

Super Eagles forward Cyriel Dessers

Since em enter keke come Rangers from Cremonese for July 2023, Dessers don manage gather 51 goals and 13 assists. E be like juju.

Inside Scottish Premiership alone, he score 18 goals and provide 2 assists—na real striker wey no dey play.

Wahala Match But Dessers’ Goal Against Hibernian na em Shine Pass

Even though Dessers open scoring early, Kieron Bowie level am immediately for Hibernian with one better finish.

Cyriel Dessers don end season with goals for straight games as Rangers finish with gbas gbos

Rangers come suffer as Leon Balogun, wey no gree retire until em leg break finish, come kuku woundjure, Robin Pröpper enter, replace am.

Rangers find second goal for 50th minute as Raskin use head score from James Tavernier corner.

But Hibernian no stubborn head pass Maiduguri goat own, Martin Boyle use him head again equalise after better cross from Nicky Cadden—match end 2-2.

Still, Cyriel Dessers goal against Hibernian na embe the main highlight of the match, as the Super Eagles striker don score six goals for straight times—against St. Mirren, Celtic, Aberdeen, Dundee United, and now Hibernian.

Wetin We Fit Talk? Nothing oh!

As season don finish like dis, Dessers don prove say na him be Rangers’ sharpest striker.

This em last goal just seal am. With 29 goals for the season, the Super Eagles man don raise bar for next season. If he continue like this, na wahala for defenders next season.

You Like this post abi?
Oya, we go like hear from you abeg. Help us drop small comment for the box below!

Be the first to comment on "Cyriel Dessers don end season with goals for 5 straight games as Rangers finish with gbas gbos"

Leave a Reply