NThe 2024/25 NWFL Premiership Super Six end with gbege wey shock everybody as Bayelsa Queens carry the NWFL Super Six crown after dem tear Naija Ratels 4-1 for the last match of the playoffs.
Na better historic end to the season be dis, as four teams—Bayelsa Queens, Nasarawa Amazons, Edo Queens, and Remo Stars Ladies—waka enter the final day with hope say dem fit carry the league title, Hitvibz reports.
Every goal, every referee whistle, and every pass matter wella for dis tightest finish wey NWFL don ever see.
Bayelsa Queens rise as Naija Ratels fall yakata
Edo Queens, wey be last season champion, jam serious Nasarawa Amazons for one of the most expect match of the day. Nasarawa just need win to carry their first title since 2017.
Dem don already gather 8 points from four matches, with two wins and two draws—dem steady well for the tournament.
Edo Queens too no bad with two wins, one draw and one loss—but even if dem win, dem still need luck from other matches.
Wahala burst as Nasarawa captain, Josephine Mathias, collect red card for 74th minute. But Edo Queens no gree use the one-man advantage well. Na so the match end goalless, and the title waka commot from both hand.
How Bayelsa Queens take waka go glory with goal galore
For another field, Remo Stars Ladies face Rivers Angels. Remo dey hope say dem fit shock everybody for their first Super Six, but Rivers Angels no gree give chance.
Titilayo Aweda score sharp-sharp for 9th minute, come add another one just after second half start. Aishat Animashaun try pull one back for Remo for 70th minute, but na too late. The game end 2-1 in favour of Rivers Angels wey finish fourth while Remo land for fifth.
But the main drama happen for where Bayelsa Queens dey. Dem know say na only win with better goal difference and small luck fit make dem champions again since 2021/22.
Vera Samuel open the scoring for 27th minute, but Naija Ratels equalise just before half-time through Itunu Adeshina.
As second half start, Cynthia Mega fire Bayelsa back into the lead sharp-sharp. From there, the Prosperity Girls no look back. Dem score two more goals and knack Naija Ratels 4-1.
Na Vera kuku nak the two quick goals like who dem put fire for her bum bum within six minutes and na so she take complete her hat-trick, come secure the trophy for the South-South Queens.
That strong win push Bayelsa Queens go top of the table and crown dem as the NWFL Super Six winners for the second time.
Final NWFL Super Six Table:
– Bayelsa Queens – 10 pts
– Nasarawa Amazons – 9 pts
– Edo Queens – 8 pts
– Rivers Angels – 7 pts
– Remo Stars Ladies – 7 pts
– Naija Ratels – 0 pts
Bayelsa Queens don climb back to the top of Nigerian women football, show say dem still get am. Dem last-day performance na classic, and dem truly deserve to be the new NWFL Super Six winners.
Dem don be six-time champions now and na dem go represent Nigeria for continental football.
Be the first to comment on "Bayelsa Queens flog Naija Ratels serious koboko to win NWFL Super Six 2025"