Super Eagles legend Brown Ideye don drop hot gist and di real koko for local fans: “NPFL no go ever better if na EPL and La Liga we dey talk about every time.”

NPFL fans dey debate after Brown Ideye statement

With this im strong talk, the naija baller don open fresh gist on top why NPFL dey suffer while foreign league dey enjoy better hype for Naija, na wetin hitvibz dey yan be dat.

Brown Ideye: ‘Make We Promote NPFL or Make We Continue dey Shame Ourselves’

For im X page, the former Super Eagles striker no hide mouth at all.

Brown Ideye dey beg.fans.to support NPFL

We dey always claim say we be the best for Africa, but sometimes e good make we cover face small,” na wetin Ideye talk be dat..

As pesin wey don play ball for West Bromwich Albion, Dynamo Kyiv, Olympiacos, and Malaga, the 36-year-old sabi wetin real top football be.

  Nasarawa Amazons Don Vex! Dem say Remo Stars babes Go Collect Wotowoto for Lafia

After small waka for Enyimba, Ideye don tire say Nigerian top league still dey struggle while fans dey use all energy debate EPL and La Liga scores.

Brown Ideye don kuku talk about NPFL crisis

NPFL Need Better Package, No Be Only Complaints

You wan make foreigners respect your players, wetin you don do to push dem?” na wetin Ideye ask sharply.

For Ideye mind, e clear say the real work na for local clubs and people wey dey run the league.

Brown Ideye Dey Para For Nigerian Fans Wey Dey Hype EPL & La Liga Pass Naija league

Better package, strong media, and fans wey go carry am for head go make Nigeria Premier Football League shine well.

  NPFL: Enugu Rangers still dey hot like Cameroon pepper as Rivers United and Shooting Stars no gree too

Fans no dey rush EPL and La Liga for nothing—na quality, good packaging and steady work dey pull dem go there.

Time don reach for Nigerian League to stand well or we go still dey lose fans for house.

For Ideye, e no do to dey make mouth say we be Africa best if NPFL still dey under carpet.

  NPFL Matchday 21: Rivers United Hold Remo Stars for Neck, Abia Warriors Dey Make Title Matter Hot

The real change gatz start from inside—clubs, players, and fans gatz dey proud of the league, talk about am, and push am go the next level.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on July 10, 2025 9:22 am by Hitvibz Media