Super Eagles baller Alhassan Yusuf really show him power for New England Revolution, but na Lionel Messi still carry the show again as Inter Miami manage knack dem 2-1 for Major League Soccer match wey happen Thursday morning.
Alhassan Yusuf Run Things for New England Revolution Midfield
Yusuf wey play full 90 minutes show why e dey important for New England team, na weytin hitvibz dey yarn be dat.
Di 24-year-old midfielder run di game well, e complete pass pass pass — 70 passes and e win pass anybody for field with 8 duels.
For di 92 times wey e touch ball, e make five passes for final third, two interceptions, and collect ball back 11 times.
Dis season, Yusuf don get one goal plus one assist already, and di match rating wey dem give am na 7.4 — but e still no reach to stop Inter Miami.
Lionel Messi Two Goals Make Inter Miami Happy
Even though Yusuf ball well, na Messi na em scatter di game.
Di Argentine GOAT cash one bad header wey Tanner Beason do for 27th minute, na so e score di first goal for Inter Miami.
Just 11 minutes later, Messi and him padi Sergio Busquets join body, Messi waka pass Aljaz Ivacic like say na training, come score di second goal.
New England Revolution try come back after first half. Luis Diaz and Tomas Chancalay wey come in later nearly score, but na Carles Gil wey blast one correct long shot 10 minutes to finish give di home fans small hope.
Las las, na Messi two goals for first half still make di koko difference, as e help Inter Miami knack their fourth straight win for MLS and jump pass Orlando City enter fifth for Eastern Conference.
3️⃣ points secured ☑️ pic.twitter.com/oCWBk4n1IG
— Inter Miami CF (@InterMiamiCF) July 10, 2025
No surprise, Messi still carry another Royal Caribbean Icon Of The Match award waka go house.
New England Revolution, wey just manage get only one win for their last 11 games, go wan bounce back when dem go jam Austin for away match this weekend.
Meanwhile, Inter Miami go wan make dem winning continue when dem go host Nashville for their home.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on July 10, 2025 8:14 am by Hitvibz Media



Stay connected