Nasarawa Amazons title hope don enter drainage for inside Nigeria Women Football League (NWFL) Super Six playoff after one tough Abia Angels side wire lock dem put for zero-zero draw on Friday afternoon.

Abia Angels goalkeeper Fatima Oloko making a save against Nasarawa Amazons

Even sef say Amazons try find win for the dying minute of the match, the gbege still end 0-0 for the second game of Matchday 4 inside Adokiye Amiesimaka Stadium for Port Harcourt, na weytin Hitvibz dey yan be dat.

Abia Angels Deny Nasarawa Amazons Crucial Super Six Points

The Aba babes enter this match with vex, as dem desperately wan change the story after Edo Queens gave dem heavy 6-2 beating for their last match.

Before that bad market, the Aba girls don already show pepper as dem hold Bayelsa Queens 1-1 and still wire Rivers Angels 1-0.

For the other side, Nasarawa sef bin dey look for where dem go pass bounce back to winning ways.

  NWFL Premiership Don Dust Down: Super Six Don Set, Five Teams Fall Go Lower League

Nasarawa Amazons coach giving instructions during the NWFL Super Six tournament in Port Harcourt

The Amazons start the tournament like fire, dem beat Edo Queens and Bayelsa Queens back-to-back, before FC Robo Queens come shock dem 2-0 for Matchday 3.

NWFL Super Six Penalty Drama Na Em Deny Amazons Late Victory

The two teams put body inside the game from the first whistle, but solid defense and clean goalkeeping keep the scoreline flat for first half.

As the second half start, the energy still high-voltage as the two coaches wire tactics block each other for midfield.

  NWFL Super Six: Nasarawa Amazons shut Edo Queens mouth as Adaobi Okah show her old club pepper

The real drama come happen for 90th minute. Abia Angels goalkeeper, Fatima Oloko, go commit error for inside box, and the referee sharp-sharp dash Nasarawa Amazons penalty—one golden chance to carry all the three points.

Adaobi Okah come step up to play the penalty, even sef say no be her the coach choose to play am.

She send the keeper go wrong side, but the ball go hit post come fly out. The whole Nasarawa bench just hold head for hand!

Nasarawa Amazons players reacting to a missed penalty during the NWFL Super Six match

With this result, Abia Angels don show say dem be real surprise package for this tournament as dem pick heart stand fit after that heavy defeat.

  Rivers Angels star Abasiofon Uwah no dey among NWFL February Player of di Month nominees

Meanwhile, Nasarawa babes go dey bite finger for that last-minute penalty miss, as their smooth waka to the NWFL title don start to shake.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on June 12, 2026 4:43 pm by Hitvibz Media