Just some days after Dynamo Brest for Belarus officially announce say dem don sign Super Falcons striker, Blessing Nkor, another Nigerian talent, Mary Aderemi, don also move go the same European side.
The young midfielder don follow Nkor footstep as she sign her own deal to play for the Belarus women’s league, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Mary Aderemi Don Complete Move to Dnepr Mogilev from Bayelsa Queens
Aderemi don officially join Dnepr Mogilev Football Club. The Belarus club confirm the news for their social media pages say dem don sign her from Bayelsa Queens.
Before she travel go Belarus, the 18-year-old midfielder bin dey play for “Prosperity Girls” (Bayelsa Queens) for the Nigeria Women Football League (NWFL).
She been dey part of the Bayelsa team wey win di NWFL for 2025.
She also represent Nigeria for youth level with the Falconets, and many people sabi her as one of the brightest young midfielders for the country.
“We welcome Mary to Dnieper Football Club and we wish her success for all the matches she go play for our team,” na so the club write.
Bayelsa Queens Celebrate Mary Aderemi Big Move Go Europe
Bayelsa Queens also confirm the gist and dem celebrate her as she komot, as dem praise how she take develop well for the club.
“Congratulations, Mary Aderemi!
We dey over-proud to celebrate your big move go Dnepr Mogilev FC for Europe! You carry the Prosperity Girls spirit with beta levels, and now you don carry am go bigger stage.
You deserve am—go shine, represent us, and make us proud! Once a Prosperity Girl, always a Prosperity Girl,” na so the NWFL team talk.
Aderemi no go only meet Blessing Nkor for the Belarus league, she go also jam her former teammate, Blessing Kasarachi Okpe, for Dnepr Mogilev.
Okpe bin play for Dinamo Minsk before where she score 11 goals, before she move go Dnepr Mogilev earlier this month.
Since Okpe don already dey ground, e go help Aderemi settle down fast and sabi how things dey waka for Belarus.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on April 17, 2026 11:40 am by Hitvibz Media
Related
Mary Aderemi: Another Naija Babe Don Follow Blessing Nkor Go Belarus Women’s League



Stay connected