The management of Wisdom Gate International School don come out to beg the Rivers State Ministry of Education make dem pity dem and open the school.

Inside Wisdom Gate International School classroom where the shelf fall

Dis one dey happen after the state govment lock the school because of the small pikin, Winnie Akekwe, wey kpai for inside classroom, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Wisdom Gate International School Beg For Reconsideration

The school say the suspension shock dem no be small, but dem ready to follow the law as the case don enter court now.

The Proprietor of the school, Toyon Obikoya, talk for interview with Nigeria Info say the whole thing dey really pain dem.

She talk say Wisdom Gate International School don try reach out to the family of the pikin to show dem empathy.

  Black Soot: Wike declares 19 bunkering, illegal refineries kingpins wanted

Even though the school dey close now, she say dem be law-abiding people and dem no go ever block the investigation wey govment and police dey do.

Solemn assembly for Winnie Akekwe at Wisdom Gate International School

To show say dem really sorry for wetin hapun, the school don arrange one solemn assembly on Friday to honor little Winnie.

Obikoya say even though the suspension heavy for their chest, dem still get respect for the authorities and the grieving family.

Court Case Load As Wisdom Gate School Wait For Hearing

As it be so, the matter no end for just locking the school. The management confirm say the case don reach court already, although dem never fix date for when hearing go start.

  Rivers govt urges citizens to desist from dumping refuse in drains

This new move dey happen after the Rivers State Commissioner for Education, Dr. Peters Nwagor, talk say Wisdom Gate International School go remain close until dem finish all investigation.

Proprietor of Wisdom Gate International School Toyon Obikoya begs government during interview

The family of the pikin still dey stand on their word say dem want justice for their daughter.

While everybody dey wait for wetin court go talk, the govment maintain say the safety of children na priority.

  Council Chairman appoints 139 Special Assistants in Rivers

For now, all eyes dey on the court to see how this the School case go end.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on April 17, 2026 8:09 am by Hitvibz Media