Naija ballers abroad wey dey play for different countries show teams serious pepper this week as dem deliver big performances for their clubs, both for league matches and important European encounters.

Emmanuel Ayaosi Assist highlights Nigerian talent in Slavia Prague's 2-2 draw

From Saudi Pro League reach UEFA Champions League, come down to England lower leagues, our Naija boys no gree carry last as dem help their different clubs collect important results, na weytin Hitvibz dey yan be dat.

George Ilenikhena Scatter Al-Ittihad Match for Saudi Arabia

Super Eagles striker George Ilenikhena return to Al-Ittihad starting lineup and use the opportunity shine well-well. The young striker open scoring before e later drop one correct assist as the Tigers hammer Al-Ettifaq 4-1.

Naija ballers abroad: George Ilenikhena leading the Al-Ittihad attack during Saudi Pro League round 10 match

The 20-year-old no dey play this season at all. For just 11 matches, e don contribute 10 goals altogether, with seven goals and three assists to im name.

This kind performance don show say Ilenikhena dey become one important player wey Al-Ittihad fit depend on anytime dem need goals.

  Emmanuel Ayaosi Don Show Face Again, Dash Two Correct Assists Help Karviná Scatter Zlín

Slavia Prague Naija Boys Show Class for Europe

For UEFA Champions League, Slavia Prague and Fenerbahçe play 2-2 draw for one match wey get plenty drama, as Naija boys inside Slavia Prague squad play important roles.

Midfielder Emmanuel Ayaosi deliver one important cross for the 90th minute, wey help im team grab late equaliser. With this assist, Ayaosi don reach six goal contributions this season.

As Ayaosi dey make things happen for pitch, im teammate Mubarak Suleiman also write im name for history book.

Emmanuel Ayaosi Assist for Slavia Prague against Fenerbahçe in the Champions League

The 19-year-old become the first Nigerian teenager to start Champions League match since Alex Iwobi do am for Arsenal back in 2016.

  Emmanuel Ayaosi shine for em debut as Slavia Prague scatter Slovácko 5-1 for Czech Liga opener

David Moses and Samuel Isife also feature for the Czech Republic club, as the young Naija boys show say dem get wetin e take to compete with big boys for European football.

Udoh Fire Goal, Onyedinma Drop Assist for England

For England, Daniel Udoh help Salford City collect one important 2-1 away win against Bristol Rovers for EFL League Two.

Daniel Udoh scores for Salford City against Bristol Rovers in League Two

The Nigerian striker score im first league goal of the season, as Salford carry the three points comot from Bristol Rovers ground. The result also help dem hold their ground for the top of the league table.

For EFL League One, Fred Onyedinma continue to deliver for Wycombe Wanderers as dem face Cambridge United for one match wey end 2-2.

  Emmanuel Ayaosi Don Fire Slavia Prague Stay for Top Czech League as Naija Boys Shine Against FC Zlín

The 29-year-old provide im second league assist of the season, setting up Jayden Wareham to score the opening goal.

Fred Onyedinma assist against Cambridge United fires Wycombe Wanderers to 2-2 draw

With this assist, Onyedinma don now record goal contribution for two league matches back-to-back, as the Nigerian winger continue to make im presence felt for England.

Last Updated on October 21, 2026 5:24 pm by Hitvibz Media