Naija young baller, Samuel Isife, show pepper for Czech First League as he score beta goal to help Slavia Prague nak Jablonec flat for ground on Wednesday evening.

Samuel Isife scoring for Slavia Prague in Czech First League match

Isife na him score the second goal as Slavia wipe the visitors 5–1 to carry the league title for the 23rd time, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Samuel Isife goal confirm Slavia Prague title

This win happen for their Round 33 match for the 1. Liga Championship Group inside Fortuna Arena.

The 21-year-old boy, wey join one of the biggest clubs for Czech Republic last January after he perform well for Dukla, don turn league champion now.

The right winger finally open him goal account for the club after 13 matches. Now, him total contribution don reach three goals and two assists.

  Olakunle Olusegun and Mubarak Suleiman Shine Wella as Naija Ballers Show Working Abroad

Samuel Isife, Igoh Ogbu and David Moses in Slavia Prague league victory action

As Isife dey carry the glory for the goal, him Naija brothers Igoh Ogbu and David Moses also play the match before coach change dem for Tomáš Vlček and Alexandr Bužek for 67 minutes.

Meanwhile, Mubarak Suleiman sit for bench throughout the game.

Slavia Prague turn the match to pure “show” as dem finish Jablonec with heavy beating.

The home team no waste time at all as Štěpán Chaloupek open floor with goal for 14 minutes.

Isife double the lead before break, and Mojmír Chytil score the third one just before halftime after Lukáš Provod give am beta pass.

Jablonec try find way come back, but everything scatter as soon as second half start.

Tomáš Holeš nack the fourth goal for 49 minutes before Chaloupek score him second goal for the night seven minutes later.

  David Moses Score Late Winner for Slavia Prague as Oluwabunmi Babajide Finish Season with 9 Goals

Naija boys join Slavia Prague celebrate success

Eduard Sobol score one consolation goal for Jablonec for 63 minutes, but that one no mean anything because Slavia don already finish work. Slavia over-power dem from start to finish.

With this win, Slavia Prague don officially carry the cup. Dem gap the people wey follow dem for back, Sparta Prague, with 7 points for top of the table.

Slavia Prague celebrating Czech First League title with Samuel Isife

Even though dem don carry cup already, Slavia still get two matches to play—dem go visit Hradec Králové on Sunday, May 17, before dem host Viktoria Plzeň for the final day, May 24.

Big congrats to Ogbu, Moses, Isife, and Suleiman as dem win the 2025/2026 Czech First Division title with Slavia Prague.

  Simy Nwankwo Score 20 League Goals As Mubarak Suleiman Score But Slavia Prague Chop Heartbreak

Back-to-Back: Slavia don show say dem be Baba for the 2025/26 Title

Remember say dem finish the 2024–25 season with 90 points to take top the table and stop Sparta Prague run. Now, dem don do am again!

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on May 14, 2026 9:21 am by Hitvibz Media