Super Eagles striker Terem Moffi don officially waka go Portuguese big club, FC Porto, dem carry am on season-long loan from French side OGC Nice.

Nigerian striker Terem Moffi happy at FC Porto

The 26-year-old forward go rock jersey number 29 as e join him international padi Zaidu Sanusi for Porto, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Terem Moffi Don Jam Coach Francesco Farioli for Porto

Moffi get chance work again with Francesco Farioli, na di same coach wey sign am for Nice for January 2023.

Terem Moffi with coach Francesco Farioli at Porto

Since e land OGC Nice, di former Lorient star don play 72 matches, score 24 goals and give 5 assists for all competitions.

Porto fit still buy am permanently for €8m by end of season, wey fit give Moffi long-term chance to shine for Portugal and Champions League.

  Tyronne Ebuehi drop em first assist for Empoli as Simy Nwankwo score 19th goal for Al Orobah

After di move, Moffi talk say e happy well well and dey grateful to Porto.

I dey proud say I dey here, dey wear di club colours. E really dey emotional for me, and I dey appreciate di president, di coach, and all di fans.”

Terem Moffi joining FC Porto on loan from Ligue 1

“Na club wey always dey fight for trophies, dey fight win games for Champions League and Liga Portugal. We sabi how important dis dey for di fans and di Porto family, so e sweet me well to dey here.”

Moffi Don Carry Porto Winning Mentality

Moffi bin part of OGC Nice wey lose 3-0 to Porto for Europa League last November 2025.

  Ademola Lookman Don Vex for Atalanta, Drop Mic, Ask Make Dem Let Am Waka: ‘E Don Do'

Two months ago, we play Porto, e no too sweet because we lose, but dis time I dey the oda side. E dey very sweet,” e talk.

Moffi talk say as player, e like dey happy for pitch, and when e dey happy, nothing else matter.

E still add say na those moments e dey perform best, dey enjoy score goals, dey work for team, and dey connect with fans.

Terem Moffi celebrating his move to Porto

E sabi say fans get high expectations, but e sure say with God hand, e go deliver all di goals wey fans wan see.

  Josh Maja worry Norwich again as West Brom comot for FA Cup for Carrow Road

Dis Porto move go give Moffi chance to play higher level football and continue his scoring form.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on January 31, 2026 6:48 am by Hitvibz Media