Na mixed night be this for Super Eagles striker Paul Onuachu. Baba first turn hero, later come turn heartbreak as Trabzonspor draw 1–1 with Antalyaspor for away match inside Turkish Super Lig round 20 on Friday night.
The Naija striker first help drag im team come back enter the game and even get chance to complete comeback, but e later miss penalty as Trabzonspor manage collect just one point for Corendon Airlines Park, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Paul Onuachu save Trabzonspor, later penalty wahala show face
Even with all the effort, the 31-year-old no really enjoy the match overall. E touch ball just 21 times for the whole game — na the least touches for any outfield player wey play full 90 minutes.
Onuachu don dey hot form this season and na key man for Super Eagles wey finish third for 2025 AFCON. But this time around, when e matter pass, e no fit deliver.
Before halftime, Trabzonspor don already dey under pressure as Van de Streek fire Antalyaspor go front just before break.
After second half start, Trabzonspor get penalty eight minutes in, and Onuachu step up sharply take slot am enter net, make the score level again.
That goal na im 13th for the season from 17 matches, plus one assist. As e be so, e dey joint top scorer for Turkish Super Lig.
The goal still mean say e don score for back-to-back matches, after im goal for the 2–1 win against Kasimpasa for their last game.
Late drama, Onuachu no fit shine again
Later for the game, gbege burst for sideline as Antalyaspor coach Sami Ugurlu collect two yellow cards sharp-sharp and dem send am go dressing room, make tension high pass before.
But the wahala no end there. With just nine minutes remaining, referee award another penalty to Trabzonspor — correct chance to complete comeback.
This time, Onuachu no fit cash in. E miss the penalty, and Antalyaspor breathe again.
Na di first time Onuachu dey miss penalty for em Süper Lig career, after e don score five for five before.
Two minutes later, dem bring im fellow Naija man Anthony Nwakaeme come in replace Felipe Augusto, but e no fit change anything. Match end 1–1 as both teams share the points.
Dis one cost Trabzonspor well, because dem no fit waka go second place or reduce gap wey dey Galatasaray. Dem still dey third with 42 points, four behind di leaders, while Antalyaspor dey 11th with 20 points.
Next match for Trabzonspor na Turkish Cup against Fethiyespor on Tuesday, while Antalyaspor go Igdir FK for di same competition.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on January 30, 2026 11:29 pm by Hitvibz Media



Stay connected